I dey always talk am say, noting wey person no go see for dis Lagos.
Di orisirisi tings wey we taxi driver dey take our mouth see for Lagos road in di curse (Olorunmaje!) of our duty, our eye no fit talk am finish.
Everyday we dey see di good, di bad and di . . . (Abeg helep me complete am. But if you say Baba Iyabo or Jagaban, na you sabi o!)
See like di order day wen I go drop passenger for Victoria Island. As I drop di passenger finish, I say make I take dat Four Point Hotel road and begin find my way. Na im one sisi like dat stop me in front of di hotel.
If you see as dis sisi take package im body, hmm, if you be man and you no swallow saliva, na im be say dat China virus don enter your body.
I sure say dat sisi been study packaging science for school. Di Brazilian hair nearly long reach im leg. Di sisi take time polish im face sote di face come dey shine like mirror.
Di two pawpaw for im chest nko? E package am sote di two pawpaw jus tanda straight like Standard Bank and na so im boysquarter shoot out and dey shake like Shakespear. Tori Olorun!
Di sisi jus use one finger stop me, I match break fiiaam. E come to driver side, bend and nearly put im head inside my window.
E come smile. If you see dis sisi teeth, you go tink say na hypo e dey take wash am every morning, afternoon and night. Di teeth shine, no be small. Na so me sef come throw am my own smile. Yes nah.
Di sisi come say make I carry am go Adeola Odekun for dat same Victoria Island. I tell am my price, e gree.
Na im I jump down to open back door for am. Di sisi say nafor front e wan siddon. I open passenger front door for am, e enter.
As we jus move small, di sisi say na dollar e wan go change for Adeola Odekun. E ask me weda I know how much dem dey take change one dollar. I tell am say I no know but make we jus dey go dia.
Di next ting be say, di sisi come talk say na abroad im dey live, dat e jus enter Naija yesterday and na for dat Four Point e dey lodge. E say but im dey alone, and e need person to keep am company till e go back next week.
E come ask me weda I go drive am around town wene change di dollars finish, and after dat, I go drop am for di hotel and I go follow am go insideim hotel room make I keep am company.
I first do like say I no hear wetin e talk becos I tink weda na mistake e make. Na im di sisi ask me weda I don gree. Olorun Oba o!
Di way di sisi take talk oyibo, e resemble Ghana sisi. Junction e go say junshien. Second gate, e go say secand giite. Money, e go call am maney.
Na im I tell am say I don hear, but dat I dey very, very busy with my work.
Di sisi say make i no worry about dat, say im go settle me for di whole day. E say im jus need somebody to stay and dey follow am talk for im hotel room.
I come tell am say wen e change im dollars finish, I go carry am go Lekki Beach wey e go see plenty people, say e feat carry one bobo for dia make e follow am dey talk for im hotel room. Sebi na jus to talk.
Dat time we don reach Adeola Odekun. Di sisi change 2000 dollar to naira. Come see money full every wia. E put di money inside im handbag but di ting still remain plenty. Na im I give am one Ghana-Must-Go bag wey don dey inside my guonguoro tipe tipe. Di money full di bag.
Na so we begin dey go Lekki Beach.
(To be continued)
Make we jam again on Tuesday.
Tank you.
Tank you very much.
And tank you very, very much indeed.
NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.