NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.
Every wia person go now, na running mate talk you go hear.
I no know wetin running mate mean tele tele. I been tink say na person name. But na one passenger like dat wey I carry for drop go Gowon Estate for Dopemu side, na im take time tell me wetin running mate mean.
I come talk am for my mind say, no wonder! So everybody don dey get running mate, na only me dey drive dis my guonguoro go every wia for Lagos everyday? Tori Olorun!
I know say I sabi drive sote all our union member dem for our garage wey dey near Ikeja under bridge give me name say I be Oga Man About Town, wey be Oga MAT in short.
Shey na name I go chop? If I dey work like dis everyday, for sun, for rain, as I don dagba finish so, shey di son of man no go peme? Olorunmaje!
I see say some fast bobo dem don dey make all dis fine, fine cinema sisi dem dia running mate. I know say na to use style enter dem. After all, instead make you jus dey swallow saliva wen you see di fine sisi dem for television, tell dem say dem be your running mate, and you don enter dem be dat patapata.
Na im make I don decide today say, next week wey dey come so, me sef go announce my running mate wey go dey helep me drive my guonguoro di day wen I tire. Di two both of us sef fit dey drive di guonguoro everyday and dey take style play for inside. Yes o. All na work nah.
Abeg, if you know any fine cinema sisi wey I go follow make running mate, tell am make e come meet me for our garage kia kia before weekend.
Make we jam again next week Tuesday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.
•Credit: Matlda’s Blog.