NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.
Noting wey man no dey see for dis Lagos. And na we taxi driver dey see pass.
Na orisirisi I dey see everyday for road left, right and center. My guonguoro no dey kukuma rest. And dat’s why I dey always service am well well.
Any passenger wey I carry dey tink say I jus buy my guonguoro, dem no know say I don buy am tipe tipe, even before dia mama born plenty of dem.
Yes nau. Na as you take care of your ting, di ting go service you. My people dey talk am say “Obe t’odun, owo logba”. Di meaning be say, soup wey sweet, na money kill am.
As my guonguoro dey kamkpe, na im make I dey always dey for road 24/7. No area for Lagos wey I no dey enter. Passenger own na to pay, my own na to carry am go anywia e wan go, weda for drop or for charter.
Shey na Oshodi or Surulere? Abi na Yaba, Itire or Lawanson? Even if na Lekki, V/I, Ikoyi, VGC, Ajah, Mile 2, Mike 12, Ogba, Agege, Iyana Ipaja, Ikotun Egbe, Apapa, Ilasamaja, Ojodu Berger, Alimosho, Ikorodu, Epe, Badagry, Somolu, Bariga, Oworonshoki etc etc. Anywia.
Na im make dem dey talk am say, if you wan know wetin dey happen any corner for Lagos, ask taxi driver.
Yesterday I carry one passenger like dat go drop for Ketu, as I say make I go turn for dat under bridge for Mile 12, begin come back to our garage wey dey near Ikeja under bridge, na so one bobo and one sisi dey do cinema for dat bus stop.
You kukuma trust Lagos people. Dem be original amebo. Any small ting wey happen kpere, you go see crowd gather dey look like say dem drink one drum of Lookozade.
If you see dat sisi, hmmmm, you go begin tink weda na mama born am. I sure say na all dis Lagos gbana sisi. E don dye im hair yellow patapata. Di kind nails wey e carry for all im finger, even hawk go run 440 if e see am.
Im clothe nko? Dat one na helele. E wear one kind mini skirt like dat wey be say if e jus make mistake bend down small, everyting for yonder go show. Di top wey e wear sef na see trough, and e come be say e no wear bra. Na so di two paw paw for im chest jus stand like Standard Bank. Tori Olorun!
(To be continued)
Make we jam again on Friday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.