NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.
Na around 10 O'clock pm in di night I take reach house dat day.
I pack my guonguoro for yard. Before I knock door sef, my wife Bose don open di parlour door. My two woman pikin dem – Bisi and Funke – don already sleep.
Bose ask me weda I go still chop wen I baf finish, I tell am say I don tire gan, say na rest I wan rest. I tell am say I no rest since morning, na so so passenger I carry.
As I baf finish, I jump inside bed, sleep don carry me be dat o. I no even know di time my wife come meet me for bed . . .
Di kind sun wey shine dat morning no get equal. Na so di sun jus dey nack for person head pom, pom, pom. And I don already put my guonguoro for road kia kia.
Wen I reach dat junction wey one side dey go Oshodi and left dey go Agege, na im one sisi stop me. E say make I carry am for drop go Ikeja. I no even waste time to open door for am as e be my route.
Di sisi enter front seat. I wan tell am how much e go pay, di sisi remove di black glass wey e wear for eye. I come see say na dat sisi wey I go drop for Ikeja GRA dat night. Ewo!
But I no dey too sure say na dat GRA sisi be dat. I look im headlamp, den come use style look im boys quarter, everyting dey kamkpe. Tori Olorun!
Come see as all my body begin shake like Shakespeare, and na so everyting for my body come tanda kpakparakpa like Standard Bank. My heart come begin do jigi jigi like railway. In short, I confuse.
Di sisi notice how my body be, na im e ask me, “Oga driver hope all is well o”. I answer am say all is well.
Na so we jus dey go, nobody talk. But I come dey use corner eye dey look di sisi. I no know say di sisi catch me.
E ask me weda I go put my guonguoro for road on Monday wey be Val day. I tell am say no day wey I no dey work. E say okay, e don book me for charter for Val day be dat. E say I go come carry am for im house, go for Beach wey di two both of us go play, chop, swim togeder from morning till evening. Tori Olorun!
I no know wen I shout Hurray, my Val!
As e talk dat one finish, e hold me, put im tongue inside my own mouth and our mouth begin make piom, piom, piom...
Na so I hear one dirty slap for my face pppooosssaaahhh!
My wife Bose begin hala. E say I must tell am who be dat my Val wey I dey kiss piom, piom, piom for dream since wey I enter bed dis night. Olorun Oba o!
Wahala be like bicycle.
Make we jam again on Tuesday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.