NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.
Since wen dis new year show face, everybody jus dey swear upandan. Dem dey talk all di tings wey dem no go do again dis year, and di new tings dem go dey do. Na wa o!
Me, e don tey wen I don dey hear all dis swear wey dem dey call New Year Res...Reso...Resolu... abeg make I sha continue with my tori, make my tongue no come cut. I know say una understand wetin I mean.
Any passenger wey I carry for my guonguoro since Saturday, na di same ting.
One sisi like dat wey I carry go drop for dia church on Sunday dey tell im friend for phone say, as husband wey e don dey pray for tipe tipe no gree come last year, e must to born pikin by force by fire.
E say e no go let any man wey wan nack am dis year use rubber lai lai. Di sisi say na body to body, bie bie to bie bie. And any man wey no like am so, make e find im way.
Anoder passenger, one bobo wey I carry dat same New Year go im house for Mangoro from Ikeja Central Mosque, jus dey talk to imsef.
Weda as e siddon for back seat, e tink say I no hear wetin e dey talk. E no know say I dey use style look im mouth for mirror.
Di bobo jus dey swear say e no go dey go meet ashewo again for Ipodo hotel dis year. E say na im make e no dey always get money pay im landlord, wey make dem trowey im load comot for house dat last year.
E say now e dey manage with im friend for face-me-I-face-you room for Mangoro, as e never see money to rent anoder house since den.
Yesterday for our garage wey dey near Ikeja under bridge, na so all our union member dem dey do new year swear.
Mutiu say e no go dey smoke wee wee and drink monkey tail to wash am down again dis year. E say di ting nearly make am run mental last year, wey make im wife carry all im pikin dem run go back to dia village for Kogi.
(To be continued)
Make we jam again on Friday
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.