NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.
I happy gan as Eledumare don carry us from January till dis time of di year wey be Odun Keresimasi.
Even dough, out of 12 month, na only 6 month my guonguoro enter road dis year.
First na Coro, after dat na #EndSARS. But I still tank Eledumare becos di two wahala been come to peme everybody, but Eledumare still helep us. No be say we better pass di people wey peme o!
Di only ting be say, some people no sabi say, as deep hole dey dia own pocket becos of Coro and #EndSARS, na so order people pocket get hole too. Dem no even wan know weda di hole for my shokoto trouser pocket deep pass dia own sef.
Na we taxi driver own bad pass. Apart from Coro and ₦EndSARS, we still get BRT, Uber, Bolt, Keke Marwa, Keke NAPEP and Kabukabu for one corner.
To see one passenger sef carry for drop for one day, na miracle. Not to talk of charter.
Na so we go siddon ti-ti-ti-ti for our garage wey dey near Ikeja under bridge, no passenger.
But people no know. As I dey nack una dis tori so, I don get like 22 I/V. Some na for wedding, some burial, some party, some na freedom, some na church programme. And all of dem wan make I put money for di envelop o. Tori Olorun!
I no even fit count how many people don call me dis month to ask wetin I go give dem for dis Xmas and New Year. Dem don call me sote dis my torch light chinko phone don develop internal heat.
Lagos sisi dem don call me tire, di ones wey I know and di ones wey I no know. How some of dem take get my number, I no know.
Na so Aisha don call me tire. Even Arike wey make me run comot for my village for Ogbomoso call me yesterday. Jumoke, one sisi like dat wey me and am meet only last week, don call me tire. And na only meet we meet o, no be say anyting shele o! If I lie make I baf naked for bafroom.
Sikiratu own be say, as I no gree pick im calls, e text one kind long list to me. E say na di few tings wey e need for dis Odun. My broda, if you see dis list, eh?, e long pass list wey dem dey give any man wey wan marry woman pikin for Igbo.
Di ting be say, I don decide wetin I go do from now till dis Xmas and New Year waka pass:
1. I no go answer any greeting again becos all dose sisi for our street for Abule Egba don dey greet me well well since dis month. People wey no dey even look my side before o. And na so dem dey add smile join dey greet.
2. I no go pick any call again by mysef. I go get PA, one fine sisi, wey go dey answer all my calls till after dis Odun.
3. All dose beg beg phone numbers, I go block dem till February 1st.
Na my plan be dat. Abi how you see am?
Make we jam again on Tuesday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.