NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.
Noting wey man no go see for dis Lagos, noting wey person no go hear.
And na we taxi driver dey see and hear pass.
My wife Bose dey always talk say my work na ashawo work, but me wey dey do di work gan sabi say na original amebo work I dey do.
Na so passenger dem go enter my guonguoro, di next ting be say dem go begin talk like parrot. If na one passenger, e go talk for phone ti-ti-ti-ti till e talk everyting wey dey inside im belle finish. And me sef go do like say I no hear anyting. Before nko?
Di madam wey I carry for drop yesterday na wa o. As di madam enter our garage wey dey near Ikeja under bridge, e dey talk for phone.
E waka dey come wia I siddon, e still dey talk for phone. E use hand signal me say make I carry am go somewia. Me sef use hand ask am wia e wan make I carry am go.
Instead make e stop di call small and tell me wia make I carry am go, e use one finger dey point for one direction like dat. Tori Olorun!
I bring out my torch light chinko phone begin do like say I dey receive call. Me sef come dey talk to ordinary phone ti-ti-ti-ti. Yes ke.
Na dat time di madam stop to talk but di phone still dey for im ear, e come talk small for my ear say “Maryland! Maryland!!”
Me sef come stop to talk to my chinko phone wey I still hold for my ear, I tell am my price small small for im own ear too.
Di madam use hand again signal me make we dey go. Na dat time I stop to talk to my chinko phone, open door and enter driver seat. Di madam open passenger seat for back and enter.
As e enter close door, na so di madam begin dey talk for phone again. Me sef start engine, put am for gear and begin fire dey go Maryland.
Di madam come dey talk:
“Is OC Crime wife there? What of DSP wife? That’s good. Has DPO wife arrived? I don’t know what is wrong with that DPO wife, that is why I keep telling my husband to watch the husband of that woman closely.
“I mean, this meeting is very important. Nobody should joke with it. These so called #EndSARS children have shown us pepper. They have driven our husbands from the roads, they now occupy everywhere.
“Nothing is coming in again from our husbands. Our children are hungry. So why is the DPO wife not there yet? We must start our own protest tomorrow whether or not she comes. We can longer eat what we want to eat again just because of #EndSARS”
Na so man pikin jus Calm Down dey listen till I drop di oga olopa wife for dia meeting place for Maryland.
Come see as olopa wife dem full for di meeting place.
As I revise my guonguoro to turn and begin go back to our garage, I no know wen I shout, “Soro Soke, Were!!!”
Make we jam again on Friday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.