Comot your leg for my neck jor

News Express |9th Jun 2020 | 1,544
Comot your leg for my neck jor

If Eledumare na man, nobody for dey see air breath. Dem for begin sell air, if you get money to buy am, you live, if you no fit buy am, you peme. But tank God no be so.

Yesterday I carry one passenger like dat go Palmgrove. As I pass Leventis, wan enter Onigbongbo Maryland, to branch enter Ikorodu Road, na im my torch light chinko phone begin ring.

As I dey for motion, I no fit answer di call. Di ting ring out. We pass Anthony, begin face Obanikoro, di phone begin ring again. Na even my passenger say make I pick my call nau.

I enter service lane, clear and park for bus stop and check di phone. I see say na our Union Branch Chairman Jimoh. I answer di call.

Jimoh ask me wia I dey. I tell am. E say make I do quick begin come back for our garage.

I ask Jimoh say I hope noting happen. Jimoh say noting but make I just dey come.

I come tink why Jimoh go say make I begin come garage kia kia. I come talk am for my mind say weda our state or national chairman don send someting come for us to take shock dis Coro wahala. I come tink weda Oga Sanwo-Olu don send wetin e promise us since New Year. I come tink weda someting don happen to any member for garage. Noting wey I no tink.

Na so I rush go drop my passenger for Palmgrove, begin rush go back our garage wey dey near Ikeja under bridge.

I drive enter garage, park my guonguoro and come down. I no see any member. But I see say everybody taxi dey – Jimoh our Chairman, Idowu (Treasurer), Akpan (Social Organiser), Emeka (Provost) etc, etc.

As I move forward small, I see say everybody dey for meeting. Iwaka enter. As I wan siddon, Jimoh say make I stand up and look my time. E say weda na now e say make I begin come back. E say I come late for union meeting, I must pay N500 fine.

I say shooo! I ask am which union meeting wey me as di Akowe no know about. Jimoh shout for my head. E say make I keep quiet, weda I don forget say na im be chairman, e get power to do anyting and na im dey INCHARGE.

I tell am say na lie im dey talk. I say as di Secretary, I must know about every meeting. In short, na me suppose to tell everybody say meeting dey.

All our union member dem come shout togeder say, “Na true Oga MAT talk!” E come be like say we plan am.

Jimoh stand up and shout O-R-D-E-R!!! Nobody mind am. Instead dem begin dey shout, “Jimoh,. comot your leg for our neck! Jimoh, comot your leg for our neck!! Jimoh, comot your leg for our neck!!!”

Na so di hole meeting place come empty. Everybody enter im taxi and enter road, e come remain only Jimoh for garage.

Yeye orange. Shey, you tink say my name na Floyd? Jimoh, comot your leg for my neck jor!

Make we jam again on Friday.

Tank you.

Tank you very much.

And tank you very, very much indeed.



Comments

Post Comment

Wednesday, September 24, 2025 12:07 PM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025