Man dey work like jackass since wen dem open Lagos road from 6 o'clock am in di morning till 8 O’clock pm in di evening.
I no mind di work sha, I like am becos money dey come nyafu nyafu.
Now, na me dey do shakara for passenger dem. No be like before wey passenger go come for our garage wey dey near Ikeja under bridge, come dey price us like say e dey price pepper and ewedu for Agege market.
If you wan take me for drop or charter now, I go show you my rate card for different area of Lagos. If you gree pay, we go. If you no gree, you waka. After all plenty passenger full ground.
Na di better ting wey dis Coro do for we Lagos taxi driver be dat. Plenty people no wan enter Danfo, BRT or Keke Marwa with order passengers. Dem wan take taxi alone, make body no touch body.
Na im make our work don boom well well, no be small. And na so, so big man and madam dem I dey carry now.
Na so one oga like dat take me for drop go Banana Island yesterday.
Wen you see dis oga, you go jus sabi say na big man be dis. If you look im shoe, you go see your face like mirror. Im jacket no be all dis “okrika wake up” wey Aboki dem dey sell for Ikeja bus stop.
Di tie wey dey im neck alone na egba. Di watch for im hand nko?Dat one na magnet. If you see di kind phone di oga carry hmm, I sure say if you sell am di money go reach you build 3 upstair.
Di oga first ask me how much be my money to Banana Island. I give am my rate card. E look am and say e go pay me double, but na cheque e go give me.
E ask me my name, I tell am say everybody dey call me Oga MAT but di name wey my papa and mama wey born megive me na Olufemi Olukayode Olugbemiro.
Na so di oga open im shine, shine bag and bring out im cheque book. E write my full name, e write my complete money and sign.
E ask me weda I get driver’s licence, I tell say yes.
After e don write everyting finish, e give me di cheque. Na so we begin dey go Banana Estate.
(To be continued)
Make we jam again on Tuesday.
Tank you.
Tank you very much.
And tank you very, very much indeed.
NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.