Me, too, I don mad o!

News Express |12th May 2020 | 1,330
Me, too, I don mad o!

Work dey go on coole since wen oga patapata open door for us make we jump out like dog dem wey dey inside cage for one month.

My guonguoro don dey see Lagos road again, and Lagos road don dey see my guonguoro.

Na so yesterday, one bobo and one sisi like dat come meet me for our garage wey dey near Ikeja under bridge. I see say di sisi jus dey hold di bobo for hand like say di bobo na small pikin.

Well, I jus talk am for my mind say na love dey shack di sisi. E fit be say e jus catch di bobo.

Di sisi say make I carry di two both of dem for drop go Yaba. I tell am my price, e gree. I say make dem enter. Dem enter, siddon for back seat.

E come be like say sleep dey catch di bobo. To talk sef, na wahala.

I come see say, any time di bobo manage open mouth and say someting, di sisi go say “Mad o!” And di ting wey di bobo dey talk, I listen tire, I no fit hear.

I take Ikeja GRA, reach Onigbongbo, from dia enter Ikorodu Road for Idi-Iroko bus stop.

As we reach Anthony bus stop, di bobo manage say someting again, di sisi shout again "Mad o!”

Wen we reach Fadeyi, to pass under di bridge for Jibowu, and begin go Yaba, di bobo manage say someting again, and again di sisi shout “Mad o!”

Na dat time I come understand: Yaba ... mad!

As we jus reach dat place wey dem dey call Yaba Left, I drive face di compound. Security wan come open di gate make I drive enter di compound, na im di sisi come shout,

“Oga taxi driver, where are you taking us to? Is this the place I told you we are going to?”

I come tell di sisi say, shebi na mad o, mad o, e don dey shout since, and I see as im bobo dey do, ehn, na im make I carry dem come Yaba Left nah, wey be di hospital for people wey get kolomental.

Na so dis sisi begin laugh. E laugh ti-ti-ti-ti sote me and all di security people for di gate confuse.

Wetin make dis sisi laugh like dis for di serious matter wey we dey talk? Abi na di two both of dem kolo?

Di sisi come talk say na dia house for Alagomeji near Yaba dia dem dey go. E say nobody mad. E say “Mad o!” na di ting wey dey reign for youth now.

E say im husband no mad, only be say e take over dose of monkey tail, wey be mixture of Sapele Water plus igbo, say na di mixture dey worry am. E say if e sleep now wake up,e go dey okay.

Na im me sef come begin laugh and shout “Mad o!”

I put my guonguoro for revise, turn and go drop dem for Alagomeji. Mad o!

Make we jam again on Friday.

Tank you.

Tank you very much.

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

Tiwa Savage denies dating Wizkid, clarifies past relationship rumours

Tiwa Savage denies dating Wizkid, clarifies past relationship rumours

 ‘No thinking, no programmes’: Jerry Gana blasts Nigerian leadership, laments rising prices

‘No thinking, no programmes’: Jerry Gana blasts Nigerian leadership, laments rising prices

Delta community cries out over collapsed bridge, abandoned road projects

Delta community cries out over collapsed bridge, abandoned road projects

Portuguese club sign five players from Lagos-based Tonic FC

Portuguese club sign five players from Lagos-based Tonic FC

Why Trump's comments on vaccines and paracetamol risk child health

Why Trump's comments on vaccines and paracetamol risk child health

'Emotions got better of me' - Ekitike's 'stupidity' opens door for Isak

'Emotions got better of me' - Ekitike's 'stupidity' opens door for Isak

More than 80 buffaloes drown in Namibia after falling off cliff

More than 80 buffaloes drown in Namibia after falling off cliff

How 3-yr-old BUA Foods became most valuable company in Nigeria

How 3-yr-old BUA Foods became most valuable company in Nigeria

10 African countries with the lowest quality of life in 2025

10 African countries with the lowest quality of life in 2025

On Sept. 10, Oracle’s stock price surged by more than a third at market open, pushing Ellison past Musk. However, the Tesla CEO regained the top spot by the end of the day, with Bloomberg valuing Musk at $384.2 billion and Ellison at $383.2 billion.

Larry Ellison, briefly the world’s richest man ahead of Elon Musk, shows off multi-million-dollar supercar collection

Larry Ellison, briefly the world’s richest man ahead of Elon Musk, shows off multi-million-dollar supercar collection

Klitschko hardest puncher I faced – Joshua

Klitschko hardest puncher I faced – Joshua

The tiny South African town the United States wants to control

The tiny South African town the United States wants to control

IBM fires 8,000 employees and replaced them with AI, only to Rehire just as many shortly after for Jobs

IBM fires 8,000 employees and replaced them with AI, only to Rehire just as many shortly after for Jobs

South Africa joins Egypt, Morocco, Ethiopia, Kenya, Nigeria, and other African countries facing new charges under the new US travel Visa program: everything You need to know

South Africa joins Egypt, Morocco, Ethiopia, Kenya, Nigeria, and other African countries facing new charges under the new US travel Visa program: everything You need to know

Would-be Trump assassin tries to stab himself in neck after guilty verdict

Obi, Ngige, Ihedioha, others grace Amaechi’s son, Chikamkpa, traditional marriage in Abuja

Obi, Ngige, Ihedioha, others grace Amaechi’s son, Chikamkpa, traditional marriage in Abuja

Trump criticises countries' migration and climate policies in scathing UN speech

Trump criticises countries' migration and climate policies in scathing UN speech

History as Enugu begins transition to Smart Green Schools

History as Enugu begins transition to Smart Green Schools

Wednesday, September 24, 2025 10:23 AM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025