Sikiratu wan finish me patapata

News Express |5th May 2020 | 1,542
Sikiratu wan finish me patapata

Na wa for yesterday Monday o. E come be like say everybody for Lagos no sleep for Sunday night rarara, dem dey wait make day jus break small make dem jumpcomot for house wey dem don dey since five weeks becos of Coro.

Me sef no jus waste time. I no even wait make 6 o’clock am in di morning nack, I don put my guonguoro for road.

I no even drive comot for our street for Abule Egba dat early morning wen four passenger stop me at di same time. E come be like say dem dey wait for me make I come out.

Come see as di four both of dem rush me like Russian. I come talk am for my mind say make dem take am easy make dem no come jam like German , den come begin shake like Shakespeare o. Becos if e happen, na so I go jus stand dey look dem like Standard Bank.

Di first person say e dey go Mile 12. Di second one say make I drop am for Lekki Phase 2. Di only sisi among dem say e dey go Ajao Estate for Mafoluku. Di last bobo say make I drop am for Maryland.

I tell di first person make e enter. As di madam enter, I tell am my price, e wan begin price as dem dey price tomato for Mile 12.

Na im I tell am say, if e no gree my price make e come down make I carry anoder person wey ready to pay. Di madam come say make we dey go.

Before I bring out ankra mask give am, di madam don put hand for im handbag, bring out one mask like dat and cover im nose. E bring out sanitizer and rub for hand, neck, leg, face, head, and even di seat of my guonguoro wey e siddon with me for front. I say na wa o, make e no come take am baf sha.

We no even move far wen my chinko torch light phone ring. I park and see say na Sikiratu dey call.Sikiratu tell me say dem don open Madam Shine buka already, say make I no fail to come o, say e don too tay wen we see last becos of Coro. I tell am make e no worry, say I must to land dia later in di day.

Na imI begin move again with my passenger to go Mile 12.

Small time, my phone begin ring again. I park to answer am. Na Sikiratu again. E ask me wetin I go bring come for am. I tell am say make e no worry, sebi e sabi say I no dey take am play.

Me and my passenger begin dey go Mile 12.

I take Alausa, enter Eleganza, burst out for 7-Up to enter Lagos/Ibadan expressway, na im anoder call enter. As I wan park, my passenger cough small. I ask am weda cough dey worry am and weda e get high fever. Di madam look me ti-ti-ti-ti.

Di madam come tell me say na me go get cough and high fever, in short na me Coro go catch. E say why I go ask am dat kind yeye question wen be say instead make I carry am go Mile 12 quick make e go see early market buy, na so so call I dey receive. I tell di madam make e no vex.

As I reach Mile 12 drop di madam, na im anoder passenger stop me. Di bobo say make I go drop am for Marina for Lagos Island. I tell am my price, e gree. I tell am make e enter.

I take Oworonshoki to take join IBB Bridge. Come see Go Slow.

For inside di Go Slow, Sikiratu no let me rest. From Oworo to Marina, Sikiratu call me like 20 times. So dis buka girl wan finish me patapata?Tori Olorun!

As I drop my passenger for Marina, na so anoder passenger say make I go drop am for Tin Can Island for Apapa.

Dat yesterday, I carry like 7 passenger go different place for Lagos. Na around 6 o'clock pm in di evening di last passenger say make I go drop am for Pen Cinema.

As we dey go, na dat time Sikiratu wan take call finish me. For one place like dat, as I say make I pick di call as I dey drive dey go, I nearly go jam trailer. Olorun Oba o!

As I drop my passenger for Pen Cinema, I see say night don dey come and small time curfew go start, na im I kukuma begin dey go my house, after all my pocket don full.

I say make Sikiratu wait. Make Madam Shine buka wait. Make My Usual wait. Make my union member dem for our garage wey dey near Ikeja under bridge wait. After all, tomorrow still dey.

Make we jam again on Friday.

Tank you.

Tank you very much.

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

Wednesday, September 24, 2025 8:36 AM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025