My guonguoro don ready for work on Monday

News Express |1st May 2020 | 1,485
My guonguoro don ready for work on Monday

Since dat night wey oga patapata talk for television say person fit commot from Monday morning reach evening, my heart jus dey do jigijigi like railway.

Man don siddon for house since one month sote e don nearly become woman. Tori Olorun!

Na so so Monday I jus dey dream since oga patapata talk finish. Lagos road go see me, and me sef go see Lagos road again.

My guonguoro don set for work. I don service di engine, gear and all di orisirisi parts of di guonguoro.

If I open ignition and start di engine now, you go tink say na pikin wey dem jus born today dey cry, you no go know say na di motor wey I don dey drive for Lagos road since before Biafra war. Yes ke!

I don buy plenty cloth to take cover nose for any passenger wey I go carry, plus including soap water to take rob for hand. Any passenger wey no wan comply, I go tell am bye bye. I no fit allow anybody come koba me with Coro. Olorunmaje!

I jus dey tink how e go be wen all our union member dem jam again for our garage wey dey near Ikeja under bridge.

Oga patapata say everybody must disappear for road by 8 O’clock pm in di evening. No wahala. Before I close everyday, I go first go Madam Shine buka go take “My Usual” enough to cover all di bottle wey I no take since dis Coro matter show face.

I jus dey tink how e go be wen me and Sikiratu jam again for Madam Shine buka. Di buka girl don kukuma call me since dat night wey oga patapata talk, say I must to report for dia buka sharp sharp on Monday.

I jus dey tink how e go be wen Aisha bring im market come sell for us for our garage again. Di mobile buka girl don dey call me since yesterday say e no fit wait to see me again.

Abeg, make di son of man enter Lagos road again, make I no come turn to mumu for house.

Make we jam again on Tuesday.

Tank you.

Tank you very much.

And tank you very, very much indeed.



Comments

Post Comment

Wednesday, September 24, 2025 8:36 AM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025