Bose don get PhD for Coro affairs

News Express |24th Apr 2020 | 1,566
Bose don get PhD for Coro affairs

I still dey tink weda I go fit continue with my taxi driver work again after dis Coro (or Koro, as di case may be)

If you see me now, ehn! Person wey see me before oga patapata force us to siddon for house, no go ever sabi me again. I fat pass Fatima sef.

So if Coro go now, and oga patapata say make we start work again, how I go take dey enter my guonguoro? Dat one go be impopo!

Na so so food I jus dey chop now. After food na sleep. I go wake up again and begin chop, den sleep again...and so on and so forth.

Bose, my wife, dey try no be small. Na orisirisi food na im e jus dey cook. Na dis Coro time make me know say na woman sabi manage pass. Forget all dose big oga dem for bank and order company wey dey claim manager. None of dem near Bose for manage.

I dey fear teletele say di food wey I give Bose money buykeep for house go finish before di first 14 days. As oga patapata come add anoder round, afraid catch me no be small. I tink say hungry go finish di four both of us for house – Me, Bose, and our two woman pikin dem – Bisi and Funke. But as Bose take manage di food make e reach us till now, I give am PhD for Coro Affairs. I sure say di food wey remain for house go reach Monday wey be di last day.

Di only ting be say, dis one wey I don dey take corner ear hear say dem wan add anoder round to siddon for house, na im I no come sabi.

Shey gofment dey plan to carry all of us go lock up for Aso Rock make we dey wack gofment food? If na so, abeg make dem even tell us to siddon for house for anoder one year sef, no troublem.

But if na jus to take mouth tell us say make we jus siddon like dat – no work, no food – hmm, na dia wahala dey o! Make una helep us beg dem o.

Make we jam again on Tuesday.

Tank you.

Tank you very much.

And tank you very, very much indeed.



Comments

Post Comment

Wednesday, September 24, 2025 8:34 AM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025