Re: Guonguoro for sale!

News Express |17th Apr 2020 | 1,406
Re: Guonguoro for sale!

Make una see me, see troublem o.

Since dat day wey I announce say I wan sell my guonguoro to use the money chop with my family for dis Koro period wey oga patapata say make we siddon for house, I no sabi peace again.

People wey sabi my number no let dis my torch-light chinko phone rest again. Na so I dey charge my battery per second per second becos of too many call and sms.

Even people wey I no dream one day say dem get my number dey follow call. I no know how dem take get am.

See di sms wey some of dem send:

Dear Oga MAT,

Why you wan sell your guonguoro – di only work tool wey you get for your life? Which work you go come dey do wen Koro come go? Abeg tink twice before you begin suffer your family o.

– Modupe Adebisi

Abeokuta

Dear Oga MAT,

If your guonguoro still dey kamkpe as you talk, abeg I get interest. Which day and for which place I go come inspect am as road no dey to take come meet you near Ikeja under bridge wia una garage dey? Wat is di brand?But I no go fit pay more dan 10k as e be say na old motor wey u don dey take do taxi since 1967 wey my mama no even born me.

– Chinedu Obidiegwu

Nnewi, Anambra State

Dear Oga MAT,

Instead make you sell your guonguoro becos of Koro, why una union executive no gather money take do palliative for una member dem as gofment own no reach anybody? After all, na you be union secretary (akowe). Talk to Jimoh your chairman and Idowu your treasurer. Abi Idowu wan talk say no union money dey for im hand?

– Mustapha Abdullahi

Daura, Katsina State

Dear Oga MAT,

I take God name beg for you, no sell am for your guonguoro. If you sell it, which job you will dey do after Coronavirus? Please don’t sell it. Please I will no wan miss all your sweet gist. We for US dey love your gist very well, we don’t ever miss it. If your oga patapata extend shutdown again without palliative, tell me. We in diaspora will organise “Save Oga MAT Guonguoro Now” take raise money for you in dollars. Abeg no laugh my pigin English. I be oyibo man. I jus dey learning it. Na im make I dey broke am any how.Thank you.

– Sandra Brooks

Florida, USA

Na only Sandra Brooks message enter my head. Abeg anybody wey near oga patapata, make you helep me tell am say, wen dis second round of Koro lockdown expire, make e renew am. And make e forgot me, weda or wedan’t gofment food dey.

Make we jam again on Tuesday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.



Comments

Post Comment

Wednesday, September 24, 2025 8:38 AM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025