Guonguoro for sale!

News Express |14th Apr 2020 | 1,464
Guonguoro for sale!

Dis Koro don carry plenty wahala come for Naija, no be small. Lagos own na im bad pass. I don siddon for house sote nyansh don begin dey pain me.

If na only nyansh pain, person for bear am. But now everyting wey dey for house don finish – food, pure water, chewing stick, bafing soap, soap to take wash plate and clothe – everyting!

Even before oga patapata order us make we siddon for house, we for Lagos don start am. Since den, my guonguoro no dey work. I jus park am for one corner of our compound for Abule Egba.

Di only ting wey I dey do be say, every morning and evening, I go warm di engine. But as I wan warm am yesterday morning, I see say petrol don finish for tank. And we don use all di money wey we get, home and abroad, take chop. No money to take buy petrol. Olorun Oba o!

Since dat yesterday till now wey I dey nack una dis tori so, I never warm my guonguoro. And I jus dey talk am for my mind say make di battery no come peme.

If battery peme, and petrol no dey to dey warm am, na im be say di guonguoro don useless nah. And nobody know wen oga patapata go say make we begin go hustle for our daily bread, as dem no gree give us gofment bread. Tori Olorun!

Na im make I say I wan sell my guonguoro.

No fear say na old motor, I dey maintain am well well. Since 1967 wey I don dey use am do taxi driver work for Lagos after I learn mecho work finish, I dey service am every week.

I no dey take my guonguoro play becos of di orisirisi passenger wey I dey carry.

Some woman passenger dem dey wey be say, if you see di kind ting wey dem carry for back, afraid must to catch you. E go be like say immediately dem enter, di guonguoro go jus faint.

But my guonguoro dey withstand gidigba. No shaking! Dat’s why I dey always make sure say all my four tyre, plus including spare tyre, na tear rubber, no be tokunbo. Na im make my guonguoro dey withstand any attack weda na from left, right or center.

I go give one year guarantee to anybody wey don ready to buy am now, now, now. I go even give di person discount. At list, make man see money chop with di family till any time oga patapata say make we begin work again.

Trust my guonguoro. Even dough na old reliable, e no fit disappoint ra-ra-ra. A try will confuse you. If na lie, make I tanda naked baf for bafroom.

Make we jam again on Friday.

Tank you.

Tank you very much.

And tank you very much indeed.



Comments

Post Comment

Wednesday, September 24, 2025 8:43 AM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025