NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.
Some tings dey happen for dis world, I swear!
Dis Coro wey dem talk say e don dey show face again for Naija, afraid dey catch me o, becos I know wetin di ting show people tele tele.
See person like Mutiu wey be our union member for our garage wey dey near Ikeja under bridge, di bobo hear nwi dat time wey oga patapata shutdown di hole Naija.
E no good make person remember wetin happen dat time rarara.
Di last day wey all of us go our garage before di lockdown, nobody see Mutiu. We come dey fear weda Olopa, Soja, FRSC, LASTMA, Maja Maja, Yellow Fever abi Council don arrest am for road carry am go lock for station.
Im phone sef no gree go, e dey always talk say “Dis line cannot be reach”.
Na after like one week Mutiu call our union chairman Jimoh, e say dat night gan gan wey oga patapata announce lockdown, na im e travel go Lokoja for Kogi go meet im family.
Mutiu na Kwara man but im wife be teacher for Kogi. And im 3 woman pikin dem dey for Kogi with dia mama.
As we siddon for garage dey nack tori dat day, Mutiu jus appear like ghost.
Come see as everybody for garage jump, shout, sing and dance to take welcome Mutiu back for Lagos.
Mutiu no come look like di Mutiu wey we sabi. Come see as im belle shoot out pim, like DPO belle. And I no come know Mutiu bie bie and Ojukwu own which one plenty pass.
But im body fine sha. Everybody come dey talk say im Kogi wife do overtime for Mutiu body.
Na after later Mutiu come call me one corner, dey tell me wetin e take im eye see for im wife hand for Kogi.
E say di first week wey e reach Kogi, im wife and pikin dem happy well well to see am.
E say dat time wey Coro strong well well, food no lack for house. E dey chop orisirisi food. E go chop, sleep, wake up, chop, sleep wake up and chop. Plus including bend bend sleep, all combine.
Mutiu say one day e come ask im wife weda na dis small private primary school teacher work dey give am all dis money wey e dey take stock food like dis for house.
And come see orisirisi clothe, shoe and handbag for im wife wardrobe. Tori Olorun!
E say na dat day di wife come gboro for am. Mutiu say noting wey im wife no tell am. Sote e tell am weda na di chechere money wey e dey get for im yeye taxi driver work for Lagos e for use take care of di family.
E say small time, im wife go comot for dat lockdown dat time, e no go come back till midnight.
Im first pikin wey be like 7 year old come tell am say na uncle place e go. E say anoder uncle sef dey come sleep for dia house wen e never come Kogi. Olorun Oba o!
Mutiu say na dat very day e begin plan to come back Lagos, but road no come dey. E jus manage take corner corner road reach im village for Kwara. E say na for village e dey with im first wife till di day wey e come back so.
Na becos of dis kind ting wey im wife do am dat time make Mutiu come meet me yesterday wey e hear for television say Coro don dey show face again for Naija. E say if na true say Coro don come back, e better sef make e siddon here make di Coro kill am.
After, Mutiu come talk say, na im make e wan marry new wife wey go stay with am for Lagos. Na so e come look ground, shake im head, den come look my face ti-ti-ti.
Small time Mutiu smile, hold my hand and say:
“Yes! Oga MAT!! Now I remember!!! Wetin be dat your second pikin name?”
(To be continued)
Make we jam again on Friday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.
•Credit: Matilda’s Blog.