NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.
Na only Eledumare go save di son of man for all dis Lagos sisi dem hand.
Since dis week show face, e come be like say all di Lagos sisi remember me, all becos say Sallah don come.
I don first settle Sikiratu becos Sikiratu sef dey settle me well well wen my own odun come.
Na Iyabode first come for our garage wey dey near Ikeja under bridge. Na di girl wey dey carry ewa agonyi for head dey waka from garage to garage dey sell. Iyabode wey I never see since dis month, come ask me weda I no go do Sallah for am.
I first tink say na joke. Before I answer am sef, di mobile buka girl don bring out paper for im bra give me.
I look di paper, Iyabode don list tings wey e wan make I buy for am to take do Sallah. I look di total money, e pass 250k, plus ram o.
I no come know wetin to tell am. I jus smile, den tell am say make e come Friday evening, say I go see wetin I fit do. If you see as Iyabode dobale dey tank me like say na me be Oba of Lagos. Tori Olorun!
Dat same day for evening, na im Jumoke sef come. Jumoke own come be like say I dey owe am money, or say e give me money make I hold for am.
As e jus enter our garage, instead make e go meet Mutiu wey dey buy monkey tail for im hand, na me wey no be im customer e come meet. Wetin concern me with monkey tail and igbo?
Jumoke tell me say, e come make I carry am for my guonguoro go buy ram for Kara. I tink say weda na drop or charter e wan make I carry am go di ram market.
I ask am how much e wan pay, Jumoke say pay ko, pay ni. E say why I come do like I forgot say na Sallah we dey, wey I suppose give am someting, even if na only ram. E say weda I no dey shame.
I ask am make I give am Sallah ram as what? E say weda I tink say e no know say I like am for di bottom of my heart. E say im sef like me, but e jus dey play with our union member Mutiu becos na Mutiu dey buy market for im hand. I shock, no be small.
I tell am say, no wahala, make e come Friday evening, say I go see wetin I go fit do. Jumoke tell me make I sure say I wait for am o.
Jumoke no even comot sef wen my torchlight chinko phone begin ring. I look, I no see name of person wey call. I pick di call sha. E come be say na Aisha dey call.
I tink say na wrong number. I ask am weda na mistake e make, e say na me e dey call. Aisha tell me say make I wait for am Friday evening, say e wan come collect Sallah money for my hand.
See Aisha wey dey carry hot agbo come sell for our garage and I never one day buy im market. I never drink My Usual finish, shey na agbo I go come dey drink?
Well sha, I tell Aisha say I go wait for am, but make e make sure say e reach garage before 4 O’clock pm in di evening becos I go close quick dat Friday, wey be yesterday.
I come dey feel as Aisha kneel down patapata dey tank me for phone in advance.
After di call, I come talk am for my mind say, na wetin all dis sisi dem tink say I be sef? Shey na mumu abi na ode?
How dem wan take reap for wia dem no sow? How be say dem go sow for Borno, den wan go reap for Ekiti or Uyo or Enugu? Dat one possible?
Na im make, since dat yesterday, I no show face for garage rarara. I know say all of dem go don bring dia mat and pillow lie down dey wait for me make I come do Sallah for dem. Tell dem say I no dey, I don travel.
I go dey put my guonguoro for road everyday, I no go near garage till after Sallah. Awon olori bruku!
Make we jam again on Friday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.
•Credit: Matilda’s Blog.