NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.
I don talk am tipe tipe say, dat conference wey woman dem go do for Beijing dat year 1985, na im go scater dis world patapata.
Imagine, instead of to talk behind, now dem dey say “beside every successful man, there is a woman”. Besides ko, under ni.
Since after dat conference, dis world no be di same again. Abi I lie?
Go price shokoto trouser now for market, di ting don cost gan. Why? Woman dem no let shokoto remain for market again. Na so dem dey struggle upandan with man to wear shokoto and shirt. Dia talk now be say, anyting wey man fit do, woman go do am better.
Na so Bose wake me up for midnight di order day. Sleep worry me gan becos dat evening, as I close for our garage wey dey near Ikeja under bridge, I branch Madam Shine buka, take four bottle of My Usual, take shine my eye.
As Bose wake me, I ask am why, e say e wan tell me someting.
Na im I stand up, siddon for bed. I tell am go on saun.
My wife tell me say e wan begin find work. I say which kind work, e say office work. Na im I ask am weda e wan abandon im office, go do anoder work.
Na dat time Bose come show me im red eye. E say who tell me say kitchen na im office? E say from dat night, e don lef dat office for me, wetin make me tink say me sef no fit dey cook for kitchen?
My broder, I bow! I come beg Bose say make e give me time to tink about di office work matter. E say na lai, say I must to answer am today, today. Olorun Oba-o!
I come talk am for my mind say, all dis na woman liberation wey dem dey talk cause am.
Bose tell me say, weda or wedan’t I like am, in di morning e must go Balogun go buy di clothe wey e go dey wear go work.
I ask am which kind clothe e wan go buy? Bose tell me say e go like to dey wear jeans trouser with body hug, but some days e go dey wear shirt and trouser. Oti o!
Na dat time e come tell me say e don even already get work as receptionist for Casino for Ikoyi Nite Club. E say e go dey run shift – morning, day and night. E say e don tire to dey answer full time house wife wen all im mate dey work.
I tell am say if e wan work, no be for hotel casino. I say dat one na ashewo work. If to work dey hungry am, I say make e come begin dey drive taxi, since anyting man do, woman fit do better.
Bose begin curse me dat night. E say why I go call im work ashewo work. E say dis my guonguoro wey I dey drive na im be ashewo work. E say e don make up im mind to do dat Casino work, and noting fit stop am.
Na so my wife stand up, waka lef me for room. Olorun Oba o!
Since dat night, I no fit open my mouth talk. But I sabi say di bird wey dey fly for up, na ground im leg dey point. I must to find out who don spoil my wife like dis for me.
Casino na oyibo get am. Na so, small time oyibo go tell my wife make e dey wash im dog and give di dog food. From dia, oyibo fit use style make im dog dey do my wife for money. No be me and dem. I don tanda for ground gidigba. Na over my dead body Bose go do dat oyibo work.
Make we jam again on Tuesday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.
•Credit: Matilda’s Blog.