Updating your news feed...

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

























Loading banners
Loading banners...


One polis ofisa wey dem say na Michael be im name don kpai for Ibadan for one hotel afta im and one babe come kerewa too much.
Dem say di ofisa come di hotel at araund 3:15 for morning and he come.pay for short time.
Later na,di babe come meet am for di hotel.
Later di woman come tear race come out from di room come begin tell pipul say wahala dey o, say si man don fent.
One of di workas for di hotel come say from.di way di woman dey yan say e be like say na widow she be.
Di woman say na di man dey take care of her and her children sins her husband die for 2014.
Dem say di woman come begin dey cry and dey shout: “Where I wan come start from again. Na him be my helper oo.”
“Na every Sunday we dey see am before apart from wons a week. He just be like my husband.”
“Anytin wey I ask am he dey gimme.”
Di hotel pipul say dem don report di mata give police.
— Transletor: NELSON DAFE