NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.
One ting wey dey pain me well well for dis our union member dem be say, dem too get long troat. Anyting wey dem see, if dem no chop am sote dem nearly quench, dem no go comot eye.
Some of dem be say, na monkey tail be dia chewing stick for morning. Make I tell una, monkey tail na ogogoro plus igbo togeder.
Di woss of dem na all dis danfo driver dem. How man pikin go dey take monkey tail wash im mouth before e enter steering to drive? Na im make dem dey fall inside Lagoon every day.
Now na corn dey reign. You go see some driver dem go take one hand hold steering, di order hand go hold corn. Dem no go remember say na people dem dey carry. If anyting happen, tell me, how dem go do am, wen e be say all dia mind dey inside di corn?
No be only driver dem. Any wia you go now, na so so corn you go dey see for everybody mouth – for market o, road o, school o, office o, everywia! Tori Olorun!
Shey corn dey bele full person? Sote dem don give corn a.k.a. Dem call am mouth organ. For our garage wey dey near Ikeja under bridge, I don warn my union member dem tire. I dey always tell dem for our meeting say, no be becos man dey do taxi driver work, na im be say all of us don become agbero. After all, I hear say for oyibo land, even people wey don read plenty book dey do taxi driver work. Haba! Shey ogogoro and corn na food? At list, we suppose to respect oursef small if we wan make order people respect us.
I jus dey pray say dis ting wey happen to Sule last week go take style teach all our union member dem lesson.
Since last year, Sule don dey do contribution wey big pass am, to take buy new taxi as di former one don baje patapata. E don do contribution sote di bobo no get money to take give im family food again. Na so all im four wife tear race lef am, go meet order bobo dem.
All im seven man pikin dem wey e born don turn to area boys for Isale Eko. All im woman pikin dem don begin dey do night shift for Allen Avenue.
But Sule no get time for im pikin dem. Eledumare come helep am last month, e buy one tokunbo put for road. All of us come happy for am say at list Sule no loss everyting.
But since Monday last week, na im we no come see Sule again. We come begin dey look for am. We even go report di matter for Area F.
Na dis week somebody come tell us for garage say Sule dey for hospital for Okokomaiko.
Na so we come organise go visit am for hospital. Di tory wey Sule tell us come make blood nearly dry for my body.
Sule say dat morning, na im e carry one sisi like dat for drop from Idimangoro go Badagry. But as e reach for road, di sisi tell am make e park make e buy mouth organ wey one woman dey roast for road side. Di sisi buy two mouth organ, give Sule one.
Sule say as e jus put di mouth organ for mouth, e no come sabi anyting wey happen again. Sule pass out, and im passenger carry im brand new second hand tokunbo run. Olorun Oba o!
Up till now wey I dey nack una dis tori so, we still dey find Sule taxi, and I fit swear with my kini say dat motor go don pass Idiroko border tipe tipe.
Di one wey come surprise me pass be say, dis morning, Jumoke wey I never see since how long now, come prepare mouth organ bring for me for garage. E say na special gift for me. I collect am sha. But wen e don go, na im I do di sign of di cross, den come talk am for my mind say if na send dem send you come, make you go tell dem say you no see me. I don travel. Abi you tink say my name na Sule?
Make we jam again on Wednesday.
Tank you.
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.
•Credit: Matilda’s Blog