I take all di orisirisi tings wey I dey see for dis my driver work as experience. E dey pain me say I no sabi book. To say I sabi, I for begin take all dis ting write book.
Na im mak,e anytime I remember di night school wey I go for my village for Ogbomoso, and all dose yeye village sisi dem wey no allow me put eye for book, di ting dey pain me no be small. All dis risk wey man dey take for Lagos road everyday for no happen.
See like di order day for Ikorodu Road, people wey dia mama born, come dey roast like goat. Na three bobo like dat. People hang motor tyre for dia neck, pour dem petrol, den come put fire. Olorun Oba o!
Na so di three bobo begin carry fire for body dey run for dat express road. Everybody, plus including all di motor wey dey for road, run fi cover.
As I wan enter service lane make I drop one passenger like dat wey im mouth just dey do ta-ta-ta-ta like typewriter, na im one of di bobo wan jump inside my guonguoroi with fire for body. Afraid catch me no be small.
I come pity am well well. I wan use my torch light chinko phone call Fire Brigade make dem come quench di fire for di bobo body, but I see say my phone battery don peme..
I come talk am for my mind say na dis madam wey I carry make me see dis kind cinema for road dat morning. Dis madam waka come our garage wey dey near Ikeja under bridge. E say make I carry am for drop go Palmgrove. I tell am my price, e gree. I say make e enter.
Since wen e enter, na so so call e dey make. And instead make e look road, e dey talk bla-bla-bla for phone. And as e dey talk, na so e dey cut chewing gum for mouth kpai-kpai-kpai.
We reach Maryland, pass go Anthony, from dia to Obanikoro, di madam still dey talk for phone,. sote we reach Palmgrove. I tell am say we don reach Palmgrove, di madam still dey talk for phone. And di ting wey pain me be say, all dis talk no get head, e no get tail. Na only how man dey chase woman and how woman fit use wetin e get to get wetin e wan, even if e no like di man.
Na as I drive enter service lane, clear for road side and march break make I tell di madam to pay me my money and come down, na dat time di bobo wey carry fire for body wan jump enter my guonguoro with fire. Tori Olorun!
I bring out my fire killer, everybody for road begin shout Ole! Ole! Na dat time I know say di three bobo na tief. Two of dem carry di fire for body jump one fence wey dey near di bus-stop.
Dat time, Olopa dem jus land with dia motor. Dem, open fire for di one wey wan run enter my taxi. Di bullet catch am for leg. Na so e fall down, begin burn like house wey catch fire. Di hole area come scater.
I no even know wen di talk talk madam jump comot. Na so me sef put my guonguoro for gear one, begin find my way. I no wan hear stray bullet or no stray bullet.
Make we jam again on Tuesday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.
•Sourced from Matilda’s Blog
NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.