ADVERTISEMENT
ADVERTISEMENT

If you wan petrol, come meet me

News Express |23rd Oct 2020 | 1,181
If you wan petrol, come meet me

If no be dis #EndSARS matter, I no for know say plenty people like me. And dem like me sote dem ready to give me anyting.

Since Tuesday wey Oga Sanwo-Olu talk say curfew dey for Lagos, everybody dey for inside house. Dis one sef wan come pass Coro lockdown.

As dem say make we no work, na so I dey wake up every morning begin warm my guonguoro engine, top water and check oil.

Yesterday morning, as I jus open ignition say make I start engine and warm, di ting no gree start. Na so I struggle ti-ti-ti-ti, di engine no gree start.

I open di bonnet to check di caburator, na dat time I see say petrol don dry patapata for tank. To say di petrol cage dey work, sebi I for don see di petrol level.

I no come know wetin make I do. I come remember say di curfew no reach Ogun State. Tank God say Abule Egba wey I dey live with my family dey for road to Sango Ota for Ogun State.

I carry di 10 liter keg wey dey inside di boot of my guonguoro, begin waka dey go for dat Sango Ota/Abeokuta Motor Road.

I reach dat station for Ijaiye, dem no sell petrol. I waka reach Meran, no petrol. Na for Alagbado I see one station wey dey sell petrol. I branch with my keg.

Come see queue for di station, e reach like from our garage wey dey near Ikeja under bridge, go reach Allen Junction. And na people wey wan buy with keg plenty pass. Tori Olorun!

But as I manage find my way inside di petrol station, na im I hear person shout: "Oga MAT!" I look, I see say na di station manager call me.

Di manager tell one girl wey dey sell petrol for di second pump make e sell for me kia kia. Di manager ask me why I no bring my guonguoro, I tell am say not even one drop dey my tank.

Di manager say make I run go pour di wan I don buy, den bring my guonguoro to di station. And na so I do.

As I jus drive my guonguoro enter di station, everybody give way. E come be like say wen I comot, di manager don use style tell dem say na me be dat popular Lagos taxi driver wey dey nack sweet sweet tori for inside newspaper.

Na so everybody come dey look me ti-ti-ti-ti. I buy full tank for my guonguoro, den come buy for dat 10 liter keg again. Di manager go inside go bring two big 50 liter keg come give me. E say make I use dem buy petrol and return di keg any day I empty di two. Olorun Oba o!

Wen I drive comot for di station, na so everybody dey wave, dey hail me Oga MAT! Oga MAT!!

Now I get petrol full tank for my guonguoro, I get for di two 50 liter keg wey manager borrow me, and I still get for my 10 liter keg.

Petrol dey yanfu yanful, and I dey ready to dash di first 5 people wey need fuel 50 liter to share. Jus call me or come meet me if you need am.

Make we jam again on Tuesday

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.



Comments

Post Comment

Sunday, June 1, 2025 2:45 AM
ADVERTISEMENT
Over 70 years Shell banner
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025