Person wey tink say e too sabi no know say anoder person dey for anoder place wey sabi pass am gan.
All dis uniform people wey dey do check point for every corner for Lagos road don come too plenty.
For one road, you go pass like 10 check point, and na orisirisi uniform you go see. All of dem dey ask for particulars. I no know weda dem take particulars curse dem for dia village.
Dem dey always forgot say, uniform na cloth, and na tailor sew am, as Abami Eda been talk.
You go see Olopa for one check point, Soja for di next check point. Council check point dey one corner. Maja Maja, Yellow Fever, SARS, Road Safety, VIO, LASTMA, Taskforce etc etc, all get dia checkpoint. Kilode!
E remain make Man O’ War, Boys Scout, Red Cross,Boys Brigade and Girls Brigade sef start dia checkpoint. And all of dem na particulars dem dey check. Tori Olorun!
Na im make yesterday Jimoh, our union chairman, bring one popular actor come our garage wey dey near Ikeja under bridge.
We ask Jimoh why e bring di actor, wey everybody dey see im face for television, come for garage. Wetin concern actor with taxi driver?
Jimoh say di kind wahala wey all dis uniform people dey give us for road everyday don too much now.
E say na im make e use im money pay di actor make e come teach us how to faint wen any uniform person give us too much wahala for any checkpoint.
Na so all of us do fainting course for 3 hours dat day, and all of us don come sabi faint pass di actor wey teach us sef.
Now we dey wait for all dose uniform people for road make we show dem say cunny man die, cunny man bury am.
Make we jam again on Tuesday.
Tank you.
Tank you very much.
And tank you very, very much indeed.
NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.