Olopa dem don become face mask contractors for Lagos

News Express |21st Jul 2020 | 1,503
Olopa dem don become face mask contractors for Lagos

Everyday, na new tings person go see for Lagos. And na we taxi driver wey dey always dey for road 24/7 dey see pass.

Olopa na dem dey do pass. Dem like to show, no be small. And na money be dia target.

Dem go use gun dey do shakara for ordinary person, but if dem hear say amu robber don enter area, dem go even trowey di gun and took off.

Since wen Alausa House make law say everybody for Lagos must wear face mask, olopa dem don carry di hole matter for head in di name of taskforce. And wetin dem dey task and force no pass money.

See like di order day wey I comot for our house for Abule Egba, begin drive go garage wey dey near Ikeja under bridge, olopa dem stop me for Pen Cinema.

As I match break, one olopa jus dey go round dey check inside my guonguoro, one point gun for up like say e wan shoot.

Anoder one say make I come down. I come down. E say make I show my particulars. I give am both original and photocopy of all my particulars, plus including affidavit of my date of birth. Di bobo shock.

E come ask me why I no wear my face mask. I ask am which one im dey check – particulars or face mask?

Di olopa wey carry gun up come point di gun for my face, e say why I go ask im oga dat kind yeye question. E say if I make pim again, e go waste me. Shioorr!

I wan open door bring out all di face mask wey I keep inside my guonguoro, di bobo say if I move, e go shoot. Tori Olorun!

I tell am say na only me dey inside my guonguoro, I no carry any passenger, na im make I no wear face mask. I say if I carry passenger, I must wear my face mask and even give passenger face mask if e no get.

Di olopa shout for my head, e say sharrraaappp!!! E ask me which day I become lawyer wey make me begin quote law for am.

E say weda or wedan't I carry passenger, I must to wear face mask. And dat face mask must to be original one.

As e talk so, anoder olopa bring like 10 face mask come meet me. E say I must buy one and wear before dem go allow me go. I tell am say di face mask wey I get inside my guonguoro pass 10 sef, and all na original.

As I jus talk dat one, di olopa wey carry gun begin drag me go to push me inside di Black Maria wey dem don keep for one corner.

E say na today I go know say na dem be di task force wey dey incharge of face mask.

As di bobo turn back to call anoder olopa make e come join am carry me trowey for inside di Black Maria wey people don full inside, quick quick I bring out my torch-light chinko phone and call oga patapata of olopa for Lagos.

I tell di oga wetin happen, e say make I jus remain wia I dey.

Small time, di OC for di Pen Cinema check point run come meet me, e ask me weda na me be Oga MAT. I say yes.

E sayso na dat small play wey dem play with me make I call dia oga patapata?

E say make I no vex, make I carry my taxi dey go.

As I enter my guonguoro, open ignition, start engine,put am for gear one to begin go our garage, na so all di olopa for dia, plus including di one wey point gun for my head, stand for attention and salute me.

True, true police na your friend.

Make we jam again on Friday.

Tank you.

Tank you very much.

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

Wednesday, September 24, 2025 2:10 PM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025