See me see wahala o. Mr Banglovish say make I make sure say I reach Yaba for di charter contract before 7 o'clock am dat morning, and my wife Bose dey tell me make I wait carry am as e dey go Oyigbo market.
I look my torch-light chinko phone wey dey ring, na Mr Banglovish dey call me again. I know say e wan ask me weda I don begin dey come. Wetin I go come tell am now?
Di phone ring four times before I use boldface pick am. And true true, Mr. Banglovish say e don go tanda dey wait for me for Yaba bus stop so dat I no go miss my way wen I reach dia.
Mr. Banglovish ask me which area I don reach now, weda I don dey near Palm Grove.
Tell me, how I go tell person wey wan give me contract say I never even comot for my house wey dey for Abule Egba? How I go take tell am say I dey wait for my wife make e baf finish? Tori Olorun!
I come lie to Mr Banglovish say I dey inside one heavy Go-slow for Maryland. Na im Mr Banglovish ask me which kind Go-slow go dey for road dat early morning wen time sef never nack 6 o'clock am in di morning.
Which lie I go come blow again wen my name no begin with Lai?
Instead make I answer Mr. Banglovish, I use style cut di call. I rush go backyard to check weda Bose don baf finish.
I see say my wife never even enter bafroom sef, e still dey for queue dey wait for im turn to enter di face-me-I-face-you bafroom wey our Landlord Baba Braimoh build for all di 20 tenants for di compound. And Bose na number 7 for di long queue.
I nearly faint wen my phone begin ring again. Olorun Oba o!
(To be continued)
Make we jam again on Friday.
Tank you.
Tank you very much.
And tank you very, very much indeed.
NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.