Re: I dey go back to my village (2)

News Express |23rd Jun 2020 | 1,813
Re: I dey go back to my village (2)

To say I know, I no for announce di order day say I wan return to my village for Ogbomoso.

Di kind orisirisi message wey don enter my torch-light chinko phone, na wa.

Na per second per second my phone go jus dey sound prang prang. Na sms o. Na im make I don dey charge my phone battery tire since last week. And no be say NEPA dey gree bring light for our area Abule Egba. Na only darkness NEPA sabi generate. But bill go still come, and we must pay.

I say no be only me go read all dis message, I must to make una follow me read am, even dough I no fit bring all of dem here.

See like dis ones:



Dear Oga MAT,

Wia you talk say you wan run go? Me and you go go back to dat your village togeder. So you wan lef only me for Lagos? You wan kill person? Di ting be say you no sabi say I love you. Na me be dat woman wey dey sell monkey tail for una garage wey dey near Ikeja under bridge. Even dough you no dey follow buy market for my hand, I dey use style dey admire you. And na di time I don plan say I wan tell you my mind, na im you come talk say you dey go back to your village. O ti o! Abeg Oga MAT, you must to change your mind, e joor.

- Mama Iyabode

Ikeja, Lagos



Dear Oga MAT,

I don conclude arrangements say I must land for Naija immediately after dis Coro. Me and all my friends here for America no dey take your sweet, sweet gists play at all at all. Na im make, as we jus read dat your gist last week say you dey plan to go back to your village, me and my friends dem contribute money say make I bring come give you for Naija after Coro. I no go tell you how many dollars we don contribute to take support your ministry, you must to wait till I come. If I land for Lagos and I no see you, well, I go carry di money go back to US. Na as I dey read your gists everytime make me come sabi broke pigin like dis o. Shey I try?

- Emmanuella Parker

Florida, USA.



Dear Oga MAT,

You don try for Lagos. You run comot for Standard 5 for di night school wey dey your village for Ogbomoso becos Arike Papa wan take African Insurance finish you. As you talk say Arike don born dat pikin tipe tipe, na im be say di pikin go don become papa pikin too. Go back and claim your pikin, im mama (Arike), plus including your grand pikin dem. I sure say all of dem wan know you. No deceive yoursef again for Lagos say na only two woman pikin and one wife you get. Go village go claim your mandate.

-Yusuf Idris

Sokoto.



Abeg na here I go stop today. Plenty still remain but I no sure say I go fit show una all today.

Make we jam again on Friday.

Tank you.

Tank you very much.

And tank you very, very much indeed.



Comments

Post Comment

Wednesday, September 24, 2025 12:06 PM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025