I dey go back to my village

News Express |16th Jun 2020 | 1,649
I dey go back to my village

Lagos no come be as I meet am dat time wen I come learn mecho work.

Una kukuma sabi how I take run comot for my village for Ogbomoso wenArike Papa wan take African Insurance finish me, say na me give im pikin belle wen we dey for Standard 5 for our village night school.

As I run come Lagos in 1965, I first learn mecho work, after my freedom, I begin do taxi driver work. And na dis same my guonguoro I drive since dat time till today - no leave, no transfer.

Dat time Lagos sweet, no be small. Gbomo gbomo and amu robber dey but e no dey too much.

Dat time noting like kidnapping, Boko Haram or Fulani kini kan. Peace dey gan. Na faaji we jus dey do, dey chop life dey go.

But now all di bad, bad ting dem don take over. Di one wey bad pass na dis Coro.

Now, to carry passenger sef, afraid dey catch me. And na so di Coro come dey increase everyday. Tori Olorun!

Di order day, I jus siddon dey tink am for our garage wey dey near Ikeja under bridge. Dem say Coro no get cure, so wetin di son of man go come do make di ting no catch am?

Na orisirisi passsenger we dey carry everyday for dis our work. How person go come sabi di passenger wey carry Coro, wen be say dem no dey write am for face?

Dem say make we dey use facemask, I dey use am, even double. Dem say make we dey use sanitiser, I dey nearly take am baf sef. Dem say make we no dey near person, I dey try.But e no easy to do dat one for Lagos, I swear! Lagos wey people full like sand sand?

Na im make I don dey tink weda make I go my village go find better agbo wey me and my family go dey drink to take shock dis Coro. Who tell dem say agbo no fit swallow dis Coro?

No be all dis fake Lagos agbo wey all dis wayo woman dem dey carry come sell for our garage o. I mean original agbo from Ogbomoso. Na dat one Oga Seyi drink nau, wey make Coro run 440.

Abi make I kukuma pack my load go back to my village?

I hear say dat wicked Arike Papa don peme, and Arike sef don born dat pikin tipe tipe, so nobody go disturb me again.

But I confuse. Shey make I go find agbo and come back, abi make I kuku pack go village? Abeg make una helep me put mouth for dis matter.

Make we jam again on Friday.

Tank you.

Tank you very much.

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

Wednesday, September 24, 2025 12:08 PM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025