I dey go back to my village

News Express |20th Mar 2020 | 1,459
I dey go back to my village

If na like dis Lagos be dat time wen I run comot for my village for Ogbomosho, I for no come. I for say anyting wey Arike Papa like, make e do, after all, I sure say no be me give im pikin belle.

Na only be say Arike body and my body dey touch becos we siddon for di same table for class. Me and Arike dey di same Standard 5 for di night school wey di two both of us dey go for village.

As Arike get belle, im papa wan take African Insurance finish me. E say na me do am. But no be me. I swear! If na me, make I baf naked for bafroom.

Na im make I run come Lagos dat year tipe tipe. As I reach Lagos, I first learn mecho work. Wen I finish, I come dey do taxi driver work. From dia, I come marry Bose, den Oluwa come give us our two woman pikin, Bisi and Funke. Forget dat man wey Arike born for village, no be my pikin.

Since dat time wey I start dis my taxi driver work, I dey enjoy Lagos gan. But since dis korona-wetin-call show face, Lagos don turn upside down patapata.

Gofment talk say make we dey tell our passenger to wash dia hand with soap water and cover dia face like Egugun Calabar, but how many passenger wan do dat one? How many passenger dey for road sef, wey you go begin dey nack law for dem?

My wife, Bose tell me di order day say dis Sunday make I follow am go for dia church wey dey for Pen Cinema, say dia pastor wan cast and bind Korona.

Our Union Chairman sef, Jimoh don tell me say e wan carry me today Friday go im Mosque, say dia Afa wan do special prayer so dat no matter di kind passenger we carry, Korona no go ever touch us.

Dis church and mosque matter sweet me for belle, no be small.

Since yesterday, I don go deep down my iron box, go bring out di cloth wey I go wear go mosque today and church on Sunday, but see wetin come happen…

For night, na im Oga Sanwo-Olu talk am for television say e don ban church, mosque or anyting wey go make plenty people dey togeder. Tori Olorun!

Na im be say small time, dem go talk say no market again and make everybody siddon for house. Shey, dis Koro come to finish everybody for Lagos?

I dey suspect say na ObaniKoro send dis wicked Koro come for Lagos.

I don dey talk am for my mind say, if by dis week wey we wan enter so, ObaniKoro no carry im Koro comot for Lagos, I dey go back to my village make di son of man no come peme for Lagos.

But wia I go start from sef? Village wey my leg never touch since 1965 wen I run come Lagos! Olorun Oba o!

Make we jam again on Tuesday.

Tank you.

Tank you very much.

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

Man kills soldier with log of wood in Lagos, neutralised without delay

Man kills soldier with log of wood in Lagos, neutralised without delay

There’s Christian genocide in Nigeria, we welcome US intervention — CAN

There’s Christian genocide in Nigeria, we welcome US intervention — CAN

Why I slept with our maid — Married man tells court

Why I slept with our maid — Married man tells court

One of 25 abducted Kebbi schoolgirls escapes as army intensifies search for others

One of 25 abducted Kebbi schoolgirls escapes as army intensifies search for others

Organ-harvesting: Police nab suspect, rescue 4 victims

Organ-harvesting: Police nab suspect, rescue 4 victims

Nigeria's Oluwafunke Adeoye wins 2025 IBA Outstanding Young Lawyer Award

Nigeria's Oluwafunke Adeoye wins 2025 IBA Outstanding Young Lawyer Award

Lagos court sentences randy man to life imprisonment for defiling minor

Lagos court sentences randy man to life imprisonment for defiling minor

Sacrilege: Yobe community condemns grave’s desecration, pledges to support police investigation

Sacrilege: Yobe community condemns grave’s desecration, pledges to support police investigation

Lagos Govt. postpones planned Lekki-Ajah road rehabilitation

Lagos Govt. postpones planned Lekki-Ajah road rehabilitation

Alleged abuse of office: Otu dissolves Cross River LG Service Board

Alleged abuse of office: Otu dissolves Cross River LG Service Board

Saheed V The People of Lagos: When security is life (1)

Saheed V The People of Lagos: When security is life (1)

Open Letter to President Tinubu: Serial disobedience of court orders – Urgent request for Executive Intervention in the prosecution of Mazi Nnamdi Kanu and consideration of a nolle prosequi

Open Letter to President Tinubu: Serial disobedience of court orders – Urgent request for Executive Intervention in the prosecution of Mazi Nnamdi Kanu and consideration of a nolle prosequi

Ebonyi Labour Party chieftain drags alleged attackers to court

Ebonyi Labour Party chieftain drags alleged attackers to court

Catholic Priest shot dead, several residents abducted as gunmen storm Kaduna community

Catholic Priest shot dead, several residents abducted as gunmen storm Kaduna community

44 Federal Lawmakers write Tinubu, seek Nnamdi Kanu’s release

44 Federal Lawmakers write Tinubu, seek Nnamdi Kanu’s release

Pro-Wike PDP NEC expels Makinde, Bala Mohammed, Bode George, others

Pro-Wike PDP NEC expels Makinde, Bala Mohammed, Bode George, others

Security fears deepen over schoolgirls’ abduction, slain General amid new assaults

Security fears deepen over schoolgirls’ abduction, slain General amid new assaults

APC group charges Nentawe not to reduce his office, to focus on delivering Tinubu

APC group charges Nentawe not to reduce his office, to focus on delivering Tinubu

Gunmen kill Ebonyi commissioner’s brother

Gunmen kill Ebonyi commissioner’s brother

Senate halts consideration of Cocoa Management Board Bill after Tinubu’s request

Senate halts consideration of Cocoa Management Board Bill after Tinubu’s request

Tuesday, November 18, 2025 6:39 PM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025