Me and Bose dey do bend, bend sleep

News Express |10th Mar 2020 | 1,510
Me and Bose dey do bend, bend sleep

Na conoravirus everybody dey talk now.

Tank God no be Buhari shit, Buhari mess, Buhari chop, Buhari no chop, Buhari marry, Buhari do, Buhari no do, Buhari dis, Buhari dat again.

Now, dem don use conokoko block our eye.

Broda go see broda for Lagos, e no go shake hand with am. See Naija wey we don dey use to embreast tipe tipe. But noting like dat now.

I hear say even for church, people no dey embreast again. I hear say dem don fashy all dose song wey dem go sing for church and all di member dem go shake hand and embreast.

Everybody dey behave like wood now, dem forget say body no be wood. We must embreast for Naija – corona or no corona, talkless of virus.

But true true, conokoko don make afraid catch everybody. Na Lagos own bad pass. Since dat Italiano land for Lagos, tings no be di same again. Nobody trust anybody again. Everybody don become suspect. If you cough first time, den second time, people go begin take one kind eye look you. Tori Olorun!

Na im make di order day wen I wake up, I find my guonguoro key tire. Na wen our two woman pikin – Bisi and Funke – don go JAMB lesson dat morning, na im dia mama tell me say na im hide my guonguoro key.

I ask am why, Bose tell me say afraid dey catch am. E say e no wan become widow overnight.

I ask am weda e hear say person wan kill me. My wife tell me say no be so, but na dis conora ting wey oyibo man bring come for Lagos, and my own work na orisirisi people I dey carry.

Bose say, e no go gree make I put my guonguoro for road till every ting die down. E say afraid dey catch am for me.

I ask Bose say, if I no work, how we go take chop. My wife say na im make e been talk dat time say make I allow am go do dat oyibo work for dat kalokalo place for hotel. Olorun Oba o! Bose, you and dat your oyibo kalokalo hotel night duty again!

Bose say make I no shout, say no be quarrel nau. E say na becos e love me as im husband and father of our two pikin na im make e no wan make I pemenow.

Bose hold my hand enter inside room. Di two both of us siddon for bed. E put im hand around my neck and begin look my eye ti-ti-ti. I come talk am for my mind say na anoder ting dis woman dey find, no be corona matter.

But wetin man pikin go do wen woman don over power am? Body no be wood nau.

Na so me and Bose come turn morning into night again. We begin do “bend bend sleep” till afternoon.

Bose don promise me say na so e go be everyday till conoravirus go back to wia ever e come from.

Make we jam again on Friday.

Tank you.

Tank you very much.

And tank you very, very much indeed.



Comments

Post Comment

Man kills soldier with log of wood in Lagos, neutralised without delay

Man kills soldier with log of wood in Lagos, neutralised without delay

There’s Christian genocide in Nigeria, we welcome US intervention — CAN

There’s Christian genocide in Nigeria, we welcome US intervention — CAN

Why I slept with our maid — Married man tells court

Why I slept with our maid — Married man tells court

One of 25 abducted Kebbi schoolgirls escapes as army intensifies search for others

One of 25 abducted Kebbi schoolgirls escapes as army intensifies search for others

Organ-harvesting: Police nab suspect, rescue 4 victims

Organ-harvesting: Police nab suspect, rescue 4 victims

Nigeria's Oluwafunke Adeoye wins 2025 IBA Outstanding Young Lawyer Award

Nigeria's Oluwafunke Adeoye wins 2025 IBA Outstanding Young Lawyer Award

Lagos court sentences randy man to life imprisonment for defiling minor

Lagos court sentences randy man to life imprisonment for defiling minor

Sacrilege: Yobe community condemns grave’s desecration, pledges to support police investigation

Sacrilege: Yobe community condemns grave’s desecration, pledges to support police investigation

Lagos Govt. postpones planned Lekki-Ajah road rehabilitation

Lagos Govt. postpones planned Lekki-Ajah road rehabilitation

Alleged abuse of office: Otu dissolves Cross River LG Service Board

Alleged abuse of office: Otu dissolves Cross River LG Service Board

Saheed V The People of Lagos: When security is life (1)

Saheed V The People of Lagos: When security is life (1)

Open Letter to President Tinubu: Serial disobedience of court orders – Urgent request for Executive Intervention in the prosecution of Mazi Nnamdi Kanu and consideration of a nolle prosequi

Open Letter to President Tinubu: Serial disobedience of court orders – Urgent request for Executive Intervention in the prosecution of Mazi Nnamdi Kanu and consideration of a nolle prosequi

Ebonyi Labour Party chieftain drags alleged attackers to court

Ebonyi Labour Party chieftain drags alleged attackers to court

Catholic Priest shot dead, several residents abducted as gunmen storm Kaduna community

Catholic Priest shot dead, several residents abducted as gunmen storm Kaduna community

44 Federal Lawmakers write Tinubu, seek Nnamdi Kanu’s release

44 Federal Lawmakers write Tinubu, seek Nnamdi Kanu’s release

Pro-Wike PDP NEC expels Makinde, Bala Mohammed, Bode George, others

Pro-Wike PDP NEC expels Makinde, Bala Mohammed, Bode George, others

Security fears deepen over schoolgirls’ abduction, slain General amid new assaults

Security fears deepen over schoolgirls’ abduction, slain General amid new assaults

APC group charges Nentawe not to reduce his office, to focus on delivering Tinubu

APC group charges Nentawe not to reduce his office, to focus on delivering Tinubu

Gunmen kill Ebonyi commissioner’s brother

Gunmen kill Ebonyi commissioner’s brother

Senate halts consideration of Cocoa Management Board Bill after Tinubu’s request

Senate halts consideration of Cocoa Management Board Bill after Tinubu’s request

Tuesday, November 18, 2025 6:39 PM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025