Uniform na clothe, na tailor dey sew am

News Express |25th Feb 2020 | 1,450
Uniform na clothe, na tailor dey sew am

If no be becos of Arike wey make me stop for Standard 5 for di night school wey dey my village for Ogbomosho, run come Lagos, I know say I for go school well well and I for sabi book gan.

And to say I finish school, I for write all di orisirisi tings wey dey happen for Lagos inside one book,and sell di book even for America and London.

Every time of di day – morning, afternoon and night – orisirisi tings must happen for Lagos road, and na we taxi driver dey see am pass.

No place wey dis my guonguoro no dey reach for Lagos every day. Na im make dem dey call me Man About Town, Oga MAT for short.

See like di order day wey one passenger carry me for drop go Ikoyi. I take Maryland, enter Ikorodu Road to Fadeyi and climb dat bridge straight to Barrack bus stop, Stadium, Ijora Costain, Eko Bridge den to Leventis/Marina.

As we jus come down for dat bridge for Marina after CMS, to climb dat bridge wey go land us for Ikoyi, na im Go-slow come shele.

Na so we come dey go small small like snail. Wen we nearly reach di Ikoyi bridge, na im we come see wetin happen.

One bobo wear soja uniform with helmet for head like say e dey for war front. E hold horse whip for hand. Dis bobo jus dey rush one taxi driver with the horse whip, plus including dirty slap for face,ppoaarrhh, ppoaarrhh, ppoaarrhh!!!

Na so di bobo dey nack di taxi driver for head, hit am for belle and kick am for nyansh. Haba! Se di taxi driver kill person?

Small time, all of us taxi driver wey dey for dat road park and come down to know why dat bobo dey deal with our member like dat.

Wen I waka near, na im I see say na Jimoh, our branch chairman for our garage wey dey near Ikeja under bridge. So na our chairman dis bobo dey whip, slap, kick and hit like amu robber? Olorun Oba o!

All of us taxi driver dem ask di uniform bobo wetin our chairman do. E say na im cause di Go-slow wey dey for di road. We ask am how, wen be say Go-slow full every wia for Lagos since wen Oga Sanwo-Olu ban Keke Marwa and Okada? We ask am say, if e see Boko Haram, weda e fit wait and deal with am like dat. Gun sef, e no hold.

Di bobo say make we no ask am nonsense question. E say if we ask am any stupid question again, e go bundle all of us go barrack now.

See dis small boy o. Who be im age mate for here? I tell am say becos e wear soja uniform no make am get power pass everybody o.

Di next ting, I hear ppossaarrhh for my face. Tori Olorun! Me?

I tell am say na me and im today. I say na me go comot dat uniform for im body today. After all, Abami Eda talk am tele tele say, weda na soja or olopa uniform, all na clothe and na tailor dey sew am.

Na so I grab am for im shokoto trouser and begin shout, “O ti pa mi o! Make una come helep me o! E don kill me o!”

Una kukuma sabi Lagos nah, kia kia, people don full every wia. Na so people dey curse am, dem dey ask wetin make dat kind small boy slap agbalagba like me.

Small time, soja dem don land for truck. All of dem carry gun.

Wen dem hear wetin happen, dem ask di bobo who im be. Di bobo say im name na Musa. Dem ask am which soja cantonment e dey for Lagos.

Di bobo begin do like deaf and dumb. E begin stammer. Na only once wey one soja take gun nyansh nack am for head, na im Musa talk say im no be soja, say im be Man O' War. Olorun Oba o!

Na so di soja dem beg all of us taxi driver make we no vex, say make we dey go our work. And na so dem bundle Musa put for dia truck, and begin face soja barrack for Obalende.

Make we jam again on Friday.

Tank you.

Tank you very much.

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

Man kills soldier with log of wood in Lagos, neutralised without delay

Man kills soldier with log of wood in Lagos, neutralised without delay

There’s Christian genocide in Nigeria, we welcome US intervention — CAN

There’s Christian genocide in Nigeria, we welcome US intervention — CAN

Why I slept with our maid — Married man tells court

Why I slept with our maid — Married man tells court

One of 25 abducted Kebbi schoolgirls escapes as army intensifies search for others

One of 25 abducted Kebbi schoolgirls escapes as army intensifies search for others

Organ-harvesting: Police nab suspect, rescue 4 victims

Organ-harvesting: Police nab suspect, rescue 4 victims

Nigeria's Oluwafunke Adeoye wins 2025 IBA Outstanding Young Lawyer Award

Nigeria's Oluwafunke Adeoye wins 2025 IBA Outstanding Young Lawyer Award

Lagos court sentences randy man to life imprisonment for defiling minor

Lagos court sentences randy man to life imprisonment for defiling minor

Sacrilege: Yobe community condemns grave’s desecration, pledges to support police investigation

Sacrilege: Yobe community condemns grave’s desecration, pledges to support police investigation

Lagos Govt. postpones planned Lekki-Ajah road rehabilitation

Lagos Govt. postpones planned Lekki-Ajah road rehabilitation

Alleged abuse of office: Otu dissolves Cross River LG Service Board

Alleged abuse of office: Otu dissolves Cross River LG Service Board

Saheed V The People of Lagos: When security is life (1)

Saheed V The People of Lagos: When security is life (1)

Open Letter to President Tinubu: Serial disobedience of court orders – Urgent request for Executive Intervention in the prosecution of Mazi Nnamdi Kanu and consideration of a nolle prosequi

Open Letter to President Tinubu: Serial disobedience of court orders – Urgent request for Executive Intervention in the prosecution of Mazi Nnamdi Kanu and consideration of a nolle prosequi

Ebonyi Labour Party chieftain drags alleged attackers to court

Ebonyi Labour Party chieftain drags alleged attackers to court

Catholic Priest shot dead, several residents abducted as gunmen storm Kaduna community

Catholic Priest shot dead, several residents abducted as gunmen storm Kaduna community

44 Federal Lawmakers write Tinubu, seek Nnamdi Kanu’s release

44 Federal Lawmakers write Tinubu, seek Nnamdi Kanu’s release

Pro-Wike PDP NEC expels Makinde, Bala Mohammed, Bode George, others

Pro-Wike PDP NEC expels Makinde, Bala Mohammed, Bode George, others

Security fears deepen over schoolgirls’ abduction, slain General amid new assaults

Security fears deepen over schoolgirls’ abduction, slain General amid new assaults

APC group charges Nentawe not to reduce his office, to focus on delivering Tinubu

APC group charges Nentawe not to reduce his office, to focus on delivering Tinubu

Gunmen kill Ebonyi commissioner’s brother

Gunmen kill Ebonyi commissioner’s brother

Senate halts consideration of Cocoa Management Board Bill after Tinubu’s request

Senate halts consideration of Cocoa Management Board Bill after Tinubu’s request

Tuesday, November 18, 2025 5:05 PM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025