Tank you o, Oga Sanwo-Olu!

News Express |4th Feb 2020 | 1,525
Tank you o, Oga Sanwo-Olu!

Since I run comot for my village for Ogbomosho come dey do dis my taxi driver work for Lagos, life no sweet as e sweet since Saturday wey February show face.

Dem dey always talk am say, if anoder person own no spoil, your own no go better. And na true talk.

You sef check am nah. If somebody no peme or dem sack am, how anoder person go take get work?

Na im make I dey tank Oga Sanwo-Olu well well since Saturday. Oga drive all dose Keke Marwa and Okada people comot for Lagos road since Saturday, plus including ORide, MaxRide, and all di orisirisi Ride.

Come see as people dey full for all di bus stop for Lagos road now like Mushin market. Dem go tanda for bus stop every morning, afternoon, evening and night, dey wait for Keke and Okada, no show.

Some people wey get money go take taxi, people wey no get go go back house, and people wey no wan go back go begin waka for leg, dey march dey go for inside hot sun like original suffer head wey Baba Fela been sing about.

If you see as passenger dey rush us for our garage since Saturday, ehn!

Now, na we taxi driver dey do shakara for passenger, no be orderwise. And any amount we tell dem, dem ready to pay. Abi nah.

Di ting wey I dey do now be say, I no dey siddon make passenger come meet me for our garage wey dey near Ikeja under bridge. I dey carry my guonguoro enter road. If you near any bus stop wey people don full, come see everybody go rush to enter my guonguoro at di same time. Some go even beg to siddon for person leg. Na make dem jus reach wia dem dey go. But na only four passenger my guonguoro fit carry nah – one for front, three for back.

Wen I see as people dey suffer for road since Saturday, I dey pity dem gan. But some time my mind go come back.

I go remember all di money wey I don dey make since Saturday, sote I don begin dey go safe money for bank.

I go remember as I don increase di house money wey I dey give my wife Bose. Now no be every Saturday I dey give Bose di money, na every day.

I go remember how money don dey enter my hand plenty since Saturday sote I don dey do “Susu” every day weyI go take put my two woman pikin – Bisi and Funke – for University after JAMB.

I go remember how I count cash, yes raw cash, go pay Baba Braimoh yesterday for dis im yeye face-me-I-face-you house wey me and my family dey live so for Abule Egba. No be say I dey owe am before o, I jus say make I pay am one year in advance make e no come disturb me. Come see as my landlord happy dat yesterday. I sure say e go don begin to plan to marry anoder wife join Mama Braimoh.

I remember how many bottle of “My Usual” I don dey consume for Madam Shine buka every evening wen I close before I begin go house.

So, wen I remember all dis better ting, wetin go make me come dey pity people wey dey tanda for road dey wait for Keke Marwa and Okada wey dem no go ever see again lie lie.

I tank Oga Sanwo-Olu no be small. Wetin dey for my mind now na how Oga go ban all dose Uber, Taxify, ORideand all dis orisirisi Ride wey don come out now.

I trust Oga Sanwo-Olu. E go do am. E go pepper dem for me.

Oga Sanwo-Olu tank you o!

Make we jam again on Friday.

Tank you.

Tank you very much.

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

Man kills soldier with log of wood in Lagos, neutralised without delay

Man kills soldier with log of wood in Lagos, neutralised without delay

There’s Christian genocide in Nigeria, we welcome US intervention — CAN

There’s Christian genocide in Nigeria, we welcome US intervention — CAN

Why I slept with our maid — Married man tells court

Why I slept with our maid — Married man tells court

One of 25 abducted Kebbi schoolgirls escapes as army intensifies search for others

One of 25 abducted Kebbi schoolgirls escapes as army intensifies search for others

Organ-harvesting: Police nab suspect, rescue 4 victims

Organ-harvesting: Police nab suspect, rescue 4 victims

Nigeria's Oluwafunke Adeoye wins 2025 IBA Outstanding Young Lawyer Award

Nigeria's Oluwafunke Adeoye wins 2025 IBA Outstanding Young Lawyer Award

Lagos court sentences randy man to life imprisonment for defiling minor

Lagos court sentences randy man to life imprisonment for defiling minor

Sacrilege: Yobe community condemns grave’s desecration, pledges to support police investigation

Sacrilege: Yobe community condemns grave’s desecration, pledges to support police investigation

Lagos Govt. postpones planned Lekki-Ajah road rehabilitation

Lagos Govt. postpones planned Lekki-Ajah road rehabilitation

Alleged abuse of office: Otu dissolves Cross River LG Service Board

Alleged abuse of office: Otu dissolves Cross River LG Service Board

Saheed V The People of Lagos: When security is life (1)

Saheed V The People of Lagos: When security is life (1)

Open Letter to President Tinubu: Serial disobedience of court orders – Urgent request for Executive Intervention in the prosecution of Mazi Nnamdi Kanu and consideration of a nolle prosequi

Open Letter to President Tinubu: Serial disobedience of court orders – Urgent request for Executive Intervention in the prosecution of Mazi Nnamdi Kanu and consideration of a nolle prosequi

Ebonyi Labour Party chieftain drags alleged attackers to court

Ebonyi Labour Party chieftain drags alleged attackers to court

Catholic Priest shot dead, several residents abducted as gunmen storm Kaduna community

Catholic Priest shot dead, several residents abducted as gunmen storm Kaduna community

44 Federal Lawmakers write Tinubu, seek Nnamdi Kanu’s release

44 Federal Lawmakers write Tinubu, seek Nnamdi Kanu’s release

Pro-Wike PDP NEC expels Makinde, Bala Mohammed, Bode George, others

Pro-Wike PDP NEC expels Makinde, Bala Mohammed, Bode George, others

Security fears deepen over schoolgirls’ abduction, slain General amid new assaults

Security fears deepen over schoolgirls’ abduction, slain General amid new assaults

APC group charges Nentawe not to reduce his office, to focus on delivering Tinubu

APC group charges Nentawe not to reduce his office, to focus on delivering Tinubu

Gunmen kill Ebonyi commissioner’s brother

Gunmen kill Ebonyi commissioner’s brother

Senate halts consideration of Cocoa Management Board Bill after Tinubu’s request

Senate halts consideration of Cocoa Management Board Bill after Tinubu’s request

Tuesday, November 18, 2025 5:05 PM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025