My people, my lucky don arrive! (3)

News Express |31st Jan 2020 | 1,404
My people, my lucky don arrive! (3)

No be small ting dat evening o.

Na so di four both of us – Me, my wife Bose and our two woman pikin Bisi and Funke – jus dey sing and dance:

“He has done for me, he has done for me. He has done for me, he has done for me. What my father cannot do, he has done for me. What my mother cannot do, he has done for me.”

We sing and dance sote all of us come dey sweat. Small time, na im we come smell someting burn for fire. Bisi come shout, “Mummy, mummy! Di food wey you dey cook don dey burn!!”

By di time Bose run go backyard to check wetin dey for fire, everyting don burn finish.

Bose come back to parlour, instead make di food wey burn for fire pain am, e dey smile. E say make di food burn sef, after all our lucky don arrive. We go see beta money wey we go take dey cook beta food chop.

Funke come begin complain say hungry dey catch am. Come see di kind bad eye wey im mama take look am. Bose come tell our two pikin say, “Anybody wey hungry catch, make e go drink garri and sleep till tomorrow. Na wetin my darling husband go chop now na im be my concern...”

Bose no even talk finish wen Bisi and Funke shout togeder say, “Ehn?Drink garri? Lassa Fever!”

Funke come add, “Hmm, ‘my darling husband’ ke! Tank God for loan o!” Bisi and Funke come begin laugh. See as dia mama carry one big stick like dat begin pursue dem.

As Bose come back, e say make we lef dose yeye pikin dem, make di two both of us enter go discuss for bedroom. Na so my wife hold my hand enter room o. Olorun Oba o!

Di first ting Bose ask me for inside room na, “My darling, as our lucky don arrive so, how we go come use dat money?”

I tell my wife say make e wait make di money enter first. Bose say, “My darling no worry. Di money must enter, na wetin I don dey pray for since. Jus tell me how we go use di money.”

I come dey talk am for my mind say na wa o! See my wife wey dey call me “Baba Bisi, Baba Bisi” even for market. Now, e don change my name to “Darling” becos of money wey we no even see. Tori Olorun!

Na im I come tell my wife say wen di money enter, di first ting na to buy wetin dem give me di money for, wey be tear rubber car wey I go take dey work. And if di money remain, we go take am support Bisi and Funke wey wan enter university so, after JAMB.

Bose come say, “So my darling, you mean say you no get plan for me wey be your darling wife, after all dis year wey I don suffer with you? You mean say di money na for only you and your pikin dem? No, darling. You must open shop for me.”

Na so we hear as everybody for area come shout, “Up NEPA!”NEPA don bring light wey no dey since one week be dat.

Bisi and Funke rush inside and open television. Me and Bose still dey for bedroom wen I hear dem mention Cabby Finance Company for inside television.

Na im I lef Bose, rush go parlour to watch di news for television.

Come see dat my passenger wey give me di loan Form – di oga patapata of Cabby Finance Company!E wear only short knicker, no shirt for body, with handcuff for im two hand. Oga olopa for Lagos State parade am for television say na 419 kinpin and notorious amu robber.

I no know wen I shout Olorun Oba o, and fall down.

Make we jam again on Tuesday.

Tank you.

Tank you very much.

And tank you very, very much indeed.



Comments

Post Comment

Man kills soldier with log of wood in Lagos, neutralised without delay

Man kills soldier with log of wood in Lagos, neutralised without delay

There’s Christian genocide in Nigeria, we welcome US intervention — CAN

There’s Christian genocide in Nigeria, we welcome US intervention — CAN

Why I slept with our maid — Married man tells court

Why I slept with our maid — Married man tells court

One of 25 abducted Kebbi schoolgirls escapes as army intensifies search for others

One of 25 abducted Kebbi schoolgirls escapes as army intensifies search for others

Organ-harvesting: Police nab suspect, rescue 4 victims

Organ-harvesting: Police nab suspect, rescue 4 victims

Nigeria's Oluwafunke Adeoye wins 2025 IBA Outstanding Young Lawyer Award

Nigeria's Oluwafunke Adeoye wins 2025 IBA Outstanding Young Lawyer Award

Lagos court sentences randy man to life imprisonment for defiling minor

Lagos court sentences randy man to life imprisonment for defiling minor

Sacrilege: Yobe community condemns grave’s desecration, pledges to support police investigation

Sacrilege: Yobe community condemns grave’s desecration, pledges to support police investigation

Lagos Govt. postpones planned Lekki-Ajah road rehabilitation

Lagos Govt. postpones planned Lekki-Ajah road rehabilitation

Alleged abuse of office: Otu dissolves Cross River LG Service Board

Alleged abuse of office: Otu dissolves Cross River LG Service Board

Saheed V The People of Lagos: When security is life (1)

Saheed V The People of Lagos: When security is life (1)

Open Letter to President Tinubu: Serial disobedience of court orders – Urgent request for Executive Intervention in the prosecution of Mazi Nnamdi Kanu and consideration of a nolle prosequi

Open Letter to President Tinubu: Serial disobedience of court orders – Urgent request for Executive Intervention in the prosecution of Mazi Nnamdi Kanu and consideration of a nolle prosequi

Ebonyi Labour Party chieftain drags alleged attackers to court

Ebonyi Labour Party chieftain drags alleged attackers to court

Catholic Priest shot dead, several residents abducted as gunmen storm Kaduna community

Catholic Priest shot dead, several residents abducted as gunmen storm Kaduna community

44 Federal Lawmakers write Tinubu, seek Nnamdi Kanu’s release

44 Federal Lawmakers write Tinubu, seek Nnamdi Kanu’s release

Pro-Wike PDP NEC expels Makinde, Bala Mohammed, Bode George, others

Pro-Wike PDP NEC expels Makinde, Bala Mohammed, Bode George, others

Security fears deepen over schoolgirls’ abduction, slain General amid new assaults

Security fears deepen over schoolgirls’ abduction, slain General amid new assaults

APC group charges Nentawe not to reduce his office, to focus on delivering Tinubu

APC group charges Nentawe not to reduce his office, to focus on delivering Tinubu

Gunmen kill Ebonyi commissioner’s brother

Gunmen kill Ebonyi commissioner’s brother

Senate halts consideration of Cocoa Management Board Bill after Tinubu’s request

Senate halts consideration of Cocoa Management Board Bill after Tinubu’s request

Tuesday, November 18, 2025 5:05 PM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025