So, na who come be di mumu?

News Express |14th Jan 2020 | 1,524
So, na who come be di mumu?

Wen some passenger dem see my face, with all di akola mark, dem dey always tink say I don dagba finish sote I no get sense again. But I dey always laugh dem.

How can person wey don dey do taxi driver work for Lagos even before Biafra war show face, be mumu? E no possible!

Di orisirisi tings wey di son of man dey see for Lagos road every day, no book for dis world fit contain am.

Na im make, wen some passenger dem wan form over sabi, I go tell dem say dem never start.

No type of passenger wey I never carry before for dis my guonguoro – politricktian, gofment oga, business man and woman, market woman and man, school pikin dem, teacher, amu robber, gbomo gbomo, ashewo, yahoo boyz, yahoo plus, kidnapper, olopa, soja and all di orisirisi uniform people dem. Name dem!

See like di order day wen one bobo come meet me for our garage wey dey near Ikeja under bridge.

Di bobo say make I carry am for drop go Ejigbo. I tell am my price, e gree. Di bobo enter for passenger seat for front.

We no even comot for Ikeja, na im di bobo bring out one ting wey e use black nylon tie.

E say make I stop and helep am put am for my petrol tank.

I ask am how, e say wen I open di petrol tank, I go place di ting for di hole, den take tank cover hold am.

I ask am wetin di ting be, di bobo say na special market. Which kind market dem use nylon wrap like dis? Market wey no big pass apple!

I tell di bobo say if I carry passenger wey carry market, na for boot I dey put di market, no be for petrol tank.

Di bobo say, na im make e call im own special market. E say olopa no dey see im own market, dat’s why e wan hide am for di kind place olopa nogo ever tink of to search.

Na dat time I come sabi di kind passenger I carry. Olorun Oba o!

I tell am say no wahala, but for dis my guonguoro o, any market – special or not, big or small – na for boot I dey keep am.

As I jus talk like dat, di bobo come shout for my head. E call me mumu. E say na im make mumu like me no go ever make am.

E say weda I no know say, if we carry dis special market reach wia e dey go, e go settle me with big money wey go even make meabandon dis my taxi driver work.

I ask am weda I don complain to am say I no like my taxi driver work.

Di bobo come spark! E say make I stop make e come down. E say im never see di kind mumu wey I be since wen im mama born am.

Quick, quick I match my break ffiiaamm. I tell am make e come down. As di bobo jus open door come down, hang im bag for im back and begin waka dey go, na im olopa jus block am.

Na dat time I sabi say olopa dem don dey drive follow us for back since wen di bobo enter my guonguoro for garage. Dem don dey monitor di drug baron teletele.

As olopa dem block am and begin search every wia for im body, na so me I begin go my way.

Make we jam again on Friday.

Tank you.

Tank you very much.

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

Atiku blames Tinubu, security chiefs after ‘killing’ of Brig-Gen Musa Uba in Borno

Atiku blames Tinubu, security chiefs after ‘killing’ of Brig-Gen Musa Uba in Borno

PDP rift to be resolved soon, says BOT membe

PDP rift to be resolved soon, says BOT membe

1,400 vigilantes, hunters recruited to tackle killings in Plateau

1,400 vigilantes, hunters recruited to tackle killings in Plateau

Comedian Mr Jollof apologises after brawl with VDM on flight

Comedian Mr Jollof apologises after brawl with VDM on flight

Osun 2026: APC Stakeholders call for disqualification of Omisore

Osun 2026: APC Stakeholders call for disqualification of Omisore

45 kidnapped victims regain freedom under peace accord in Katsina

45 kidnapped victims regain freedom under peace accord in Katsina

Don't blindly trust what AI tells you, says Google's Sundar Pichai

Don't blindly trust what AI tells you, says Google's Sundar Pichai

Guns boom, teargas rains as Wike, Bala Mohammed, Makinde, others battle for control of PDP National Secretariat

Guns boom, teargas rains as Wike, Bala Mohammed, Makinde, others battle for control of PDP National Secretariat

TD Africa takes centre stage at Schneider Electric Innovation Day Nigeria 2025, signs landmark MoU for AI-powered data centres

TD Africa takes centre stage at Schneider Electric Innovation Day Nigeria 2025, signs landmark MoU for AI-powered data centres

Full chat between Gen. Uba and rescuers before his capture and execution by ISWAP terrorists

Full chat between Gen. Uba and rescuers before his capture and execution by ISWAP terrorists

Canada warns against travel to Nigeria, 16 other African countries in latest security update

Canada warns against travel to Nigeria, 16 other African countries in latest security update

US Religious Freedom Coalition hails Trump for designating Nigeria a Country of Particular Concern, urges swift action

US Religious Freedom Coalition hails Trump for designating Nigeria a Country of Particular Concern, urges swift action

Outrage as Nigerian immigrant stabbed to death at home in South Africa

Outrage as Nigerian immigrant stabbed to death at home in South Africa

Tension in Enugu community as Gov Mbah's kinsmen protest military invasion

Tension in Enugu community as Gov Mbah's kinsmen protest military invasion

Kebbi Abduction: How my daughter escaped after bandits killed my husband — Vice Principal’s Wife

Kebbi Abduction: How my daughter escaped after bandits killed my husband — Vice Principal’s Wife

Genocide: U.S. lawmaker alleges Tinubu lying, protecting own interest

Genocide: U.S. lawmaker alleges Tinubu lying, protecting own interest

Anambra Assembly worker dies over inability to repay loan as workers begin indefinite strike

Anambra Assembly worker dies over inability to repay loan as workers begin indefinite strike

VDM, comedian Mr Jollof risk jail over in-flight fight

VDM, comedian Mr Jollof risk jail over in-flight fight

Strike: FG’s ‘No Work, No Pay’ threat will escalate looming crisis — SSANU president

Strike: FG’s ‘No Work, No Pay’ threat will escalate looming crisis — SSANU president

Nigerian doctor sent to prison in UK for $268,000 fraud

Nigerian doctor sent to prison in UK for $268,000 fraud

Tuesday, November 18, 2025 3:31 PM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025