My New Year swear (2)

News Express |3rd Jan 2020 | 1,396
My New Year swear (2)
I dey drive dey go for road, na so I dey tink wetin dose my three passenger dem, wey I drop for Lawanson, talk say be dia New Year swear. I take dia own compare with my own four tings wey I jus remember.

Remember say Chibuike swear say e no go touch cigar again from dis new year till lai lai. Obinna say im mouth no go ever touch all dose orisirisi hot drink again. Emeka talk say im own wahala na woman. E say na anyting in skirt e dey run after, but for dis new year, e wan go marry for im village make all dis Lagos sisi dem rest for im hand.

Na im I come remember My Usual. I mean my Odekun a.k.a Black September, a.k.a. Engine Oil, orderwise known as Who Send You Come.

I come remember Sikiratu. I remember Iyabode, plus including Aisha.

I come talk am for my mind say, if I drop all dis four tings for dis new year, wetin I go come dey do nah. Abi I go come turn to wintch? Man must turn body nah, after all body no be wood. True or false?

As I enter our garage wey dey near Ikeja under bridge, I park my guonguoro. I meet our union member dem jus siddon jeje. Dem dey look demsef anya anya.

I ask our union chairman, Jimoh why everybody jus do like say person peme. Jimoh tell me say, di time I no dey, everybody make im own new year swear.

E say imsef talk say e no go ever marry anoda wife join di seven wey e don get already.

E say Idowu swear say dis new year, e no go touch all di orisirisi hot drink wey im dey consume tele tele.

E say Akpan swear say e no go get time for all dis Lagos sisi dem again dis new year.

E say na only Emeka no gree swear.

All di ting wey my union member dem swear come be di same ting wey di three passenger dem wey I jus go drop for Lawanson been swear. I say na wa o!

Jimoh come ask me wetin be my own new year swear. I first do like say I no hear am. E touch me for shoulder, and say, Oga MAT, I say wetin be your own new year swear?

I tell Jimoh say dis year o, I go mind only my darling wife Bose, I no get time for all dis Lagos sisi dem again.

Jimoh look me, I look am. E look me again ti-ti-ti-ti, me sef look am.

Jimoh come tell me say, if na so, make I transfer Sikiratu give am, make e manage am dis year. E say no be say e wan take am as anoder wife o.

I look Jimoh from head to toe. So our union chairman don dey target my Sikiratu since?

As I wan open mouth tell am my mind, I hear person touch me for neck and blow me one hot kiss nnwe! I look back, na my Siki Babe.

I come talk am for my mind say, Sorry Jimoh, I hereby withdraw my New Year swear!

Na so me and Sikiratu come go siddon for one corner, dey nack new year tori.

Make we jam again on Tuesday.

Tank you.

Tank you very much.

And tank you very, very much indeed.



Comments

Post Comment

Atiku blames Tinubu, security chiefs after ‘killing’ of Brig-Gen Musa Uba in Borno

Atiku blames Tinubu, security chiefs after ‘killing’ of Brig-Gen Musa Uba in Borno

PDP rift to be resolved soon, says BOT membe

PDP rift to be resolved soon, says BOT membe

1,400 vigilantes, hunters recruited to tackle killings in Plateau

1,400 vigilantes, hunters recruited to tackle killings in Plateau

Comedian Mr Jollof apologises after brawl with VDM on flight

Comedian Mr Jollof apologises after brawl with VDM on flight

Osun 2026: APC Stakeholders call for disqualification of Omisore

Osun 2026: APC Stakeholders call for disqualification of Omisore

45 kidnapped victims regain freedom under peace accord in Katsina

45 kidnapped victims regain freedom under peace accord in Katsina

Don't blindly trust what AI tells you, says Google's Sundar Pichai

Don't blindly trust what AI tells you, says Google's Sundar Pichai

Guns boom, teargas rains as Wike, Bala Mohammed, Makinde, others battle for control of PDP National Secretariat

Guns boom, teargas rains as Wike, Bala Mohammed, Makinde, others battle for control of PDP National Secretariat

TD Africa takes centre stage at Schneider Electric Innovation Day Nigeria 2025, signs landmark MoU for AI-powered data centres

TD Africa takes centre stage at Schneider Electric Innovation Day Nigeria 2025, signs landmark MoU for AI-powered data centres

Full chat between Gen. Uba and rescuers before his capture and execution by ISWAP terrorists

Full chat between Gen. Uba and rescuers before his capture and execution by ISWAP terrorists

Canada warns against travel to Nigeria, 16 other African countries in latest security update

Canada warns against travel to Nigeria, 16 other African countries in latest security update

US Religious Freedom Coalition hails Trump for designating Nigeria a Country of Particular Concern, urges swift action

US Religious Freedom Coalition hails Trump for designating Nigeria a Country of Particular Concern, urges swift action

Outrage as Nigerian immigrant stabbed to death at home in South Africa

Outrage as Nigerian immigrant stabbed to death at home in South Africa

Tension in Enugu community as Gov Mbah's kinsmen protest military invasion

Tension in Enugu community as Gov Mbah's kinsmen protest military invasion

Kebbi Abduction: How my daughter escaped after bandits killed my husband — Vice Principal’s Wife

Kebbi Abduction: How my daughter escaped after bandits killed my husband — Vice Principal’s Wife

Genocide: U.S. lawmaker alleges Tinubu lying, protecting own interest

Genocide: U.S. lawmaker alleges Tinubu lying, protecting own interest

Anambra Assembly worker dies over inability to repay loan as workers begin indefinite strike

Anambra Assembly worker dies over inability to repay loan as workers begin indefinite strike

VDM, comedian Mr Jollof risk jail over in-flight fight

VDM, comedian Mr Jollof risk jail over in-flight fight

Strike: FG’s ‘No Work, No Pay’ threat will escalate looming crisis — SSANU president

Strike: FG’s ‘No Work, No Pay’ threat will escalate looming crisis — SSANU president

Nigerian doctor sent to prison in UK for $268,000 fraud

Nigerian doctor sent to prison in UK for $268,000 fraud

Tuesday, November 18, 2025 3:30 PM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025