For better for woes

News Express |24th Dec 2019 | 1,670
For better for woes

Na so so marry people don dey do since dis December month show face. E come be like say dem do meeting wey dem gree say na only dis month everybody go do wedding.

If you tanda for any road for Lagos for morning time, na so nearly all di motor you see go write for body About to Wed. If you go back in di evening, na Just Wedded you go see.

Di ting sef don reach my side. No day pass wey dem no go call me make I come carry people wey wan marry.

Last week, na for Mafoluku Oshodi. Di next day, na Lekki. On Saturday, na Badagry. Sunday nko? Na for dis our Ikeja here. And all of dem na for dis my guonguoro o.

By di time dem decorate myguonguoro finish, if you see am, you fit make mistake call am Hummer Jeep. I swear! If I lie, make I tanda naked baf for bafroom.

Among all of dem wey I don carry dis month, na di one I carry yesterday I hear nwi for dia hand.

Di night before, one bobo like dat call me say make I come carry am for charter go for wedding. Di bobo send me address, e say make I make sure say I reach im house for Maryland by 7 OClock a.m in di morning.

Wen I reach dia, people don full di compound. Na wen I see dibobo wey call me for night, na im I remember say na my passenger wey I don carry tele tele, and e been collect my phone number dat time. E come be say na di bobo be di groom.

Before I close my eye and open, I no come sabi my guonguoro again. Come see how dem take decorate di hole ting, in and out. Tori Olorun!

Di bobo come talk say na me go carry im and im bride go for di place dem wan go wed for Ikoyi. E say na im make e wan di two both of dem dey togeder for my guonguoro, and na me go still carry dem after di wedding. I say no troublem. I tell am my price, e gree.

E come reach time to begin go for di wedding, Groom don enter, Bride no show face. Di bobo come dey call im bride, di phone ring out 7 times.

Di bobo open di door of my guonguoro and come down. E push everybody wey tanda for im way and enter inside room. Na so di bobo go drag im bride come force am enter my guonguoro. People jus dey fold dia hand dey look di cinema. Wetin concern me? My own na to drive dem go Ikoyi Registry.

As we dey go, groom come dey hala im bride. E ask am wetin go make am delay like dat, wey make am no gree come enter motor make dem go wed. E come talk say e dey suspect say di bride no wan marry am again becos e fit don get boyfriend.

Di bride tell am say na make up dem been dey do for im face make e look fine for di wedding nah. Before di bride even talk finish, di groom land di bride one dirty slap for face ppossaaarrhh!

Di bride cover im eyes andshout. E say e no fit see again o. Di groom say why di bridego tell am dat nonsense. E ask di bride who im dey do di make up for, if no be say e don get boyfriend? Na so I hear anoder slap, ppossaaarrhh!

And di bride sef face di groom and give am double slap for face, ppossaaarrhh! Ppossaaarrhh!! Olorun Oba o!

(To be continued)

Make we jam again on Friday.

Tank you.

Tank you very much.

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

TD Africa takes centre stage at Schneider Electric Innovation Day Nigeria 2025, signs landmark MoU for AI-powered data centres

TD Africa takes centre stage at Schneider Electric Innovation Day Nigeria 2025, signs landmark MoU for AI-powered data centres

Full chat between Gen. Uba and rescuers before his capture and execution by ISWAP

Full chat between Gen. Uba and rescuers before his capture and execution by ISWAP

Canada warns against travel to Nigeria, 16 other African countries in latest security update

Canada warns against travel to Nigeria, 16 other African countries in latest security update

US Religious Freedom Coalition hails Trump for designating Nigeria a Country of Particular Concern, urges swift action

US Religious Freedom Coalition hails Trump for designating Nigeria a Country of Particular Concern, urges swift action

Outrage as Nigerian immigrant stabbed to death at home in South Africa

Outrage as Nigerian immigrant stabbed to death at home in South Africa

Tension in Enugu community as Gov Mbah's kinsmen protest military invasion

Tension in Enugu community as Gov Mbah's kinsmen protest military invasion

Kebbi Abduction: How my daughter escaped after bandits killed my husband — Vice Principal’s Wife

Kebbi Abduction: How my daughter escaped after bandits killed my husband — Vice Principal’s Wife

Genocide: U.S. lawmaker alleges Tinubu lying, protecting own interest

Genocide: U.S. lawmaker alleges Tinubu lying, protecting own interest

Anambra Assembly worker dies over inability to repay loan as workers begin indefinite strike

Anambra Assembly worker dies over inability to repay loan as workers begin indefinite strike

VDM, comedian Mr Jollof risk jail over in-flight fight

VDM, comedian Mr Jollof risk jail over in-flight fight

Strike: FG’s ‘No Work, No Pay’ threat will escalate looming crisis — SSANU president

Strike: FG’s ‘No Work, No Pay’ threat will escalate looming crisis — SSANU president

Nigerian doctor sent to prison in UK for $268,000 fraud

Nigerian doctor sent to prison in UK for $268,000 fraud

Tinubu has less than 600 days to be flushed out — PDP chieftain

Tinubu has less than 600 days to be flushed out — PDP chieftain

Key facts about proposed UK asylum system reforms

Key facts about proposed UK asylum system reforms

Northern Governors condemn abduction of schoolgirls in Kebbi

Northern Governors condemn abduction of schoolgirls in Kebbi

Mbah okays 2025 promotion exercise for Enugu civil servants

Mbah okays 2025 promotion exercise for Enugu civil servants

Military action key to ending banditry in Zamfara — Northern elders

Military action key to ending banditry in Zamfara — Northern elders

I am proud of Super Eagles, Osimhen declares

I am proud of Super Eagles, Osimhen declares

UK to tighten refugee status, expand forced family removals under new plans

UK to tighten refugee status, expand forced family removals under new plans

Kefas orders payment of outstanding pensions, gratuities in Taraba

Kefas orders payment of outstanding pensions, gratuities in Taraba

Tuesday, November 18, 2025 1:49 PM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025