Xmas clash: Danfo drivers versus Taxi drivers

News Express |17th Dec 2019 | 1,445
Xmas clash: Danfo drivers versus Taxi drivers

Since we enter dis month of Keresimasi, orisirisi tings dey show face. Market people, gofment worker dem, school pikin o, church, mosque and even babalawo dem, all dey do Xmas promo. Television and Radio own sef berekete.


Our mother union don tap into di Keresimasi bonanza.

Na so I siddon for our garage wey dey for near Ikeja under bridge yesterday. I say make I rest small after I don go drop one passenger like dat for Apapa.

Una kukuma sabi how dat Apapa road be now. Na only Olorun go come down and solve traffic wahala for dat road.

Oga Osibande (I hope I get am right) don come try to solve di trailer menace (as e call am), e no fit. Oga Sanwo-Olu sef don try tire, no show. Di only person we dey wait for now make e come settle dis Apapa road matter na Olorun himsef.

Dats why, any passenger wey wan make we carry am for drop go dat Apapa side, e must to ready to pay double becos, wen you enter am, na di hole day work be dat.

So, as I come back from Apapa dey relax for garage, na im dispatch from our State union headquarters come our garage. Di dispatch ask me who be branch secretary for our garage, I tell am say na me be di honorable akowe of our branch.

Di dispatch hand over one letter to me, I sign for di letter and e go.

I open di letter to see wetin dey inside. Na im I see say na Xmas football competition schedule. Di competition go begin from next week till di last day of dis December for stadium. And people go buy ticket to watch am everyday.

All di union dem wey dey for transport sector for Lagos dey inside “ Yellow taxi driver dem (wey be our own), BRT, LagBus, Keke Marwa, Danfo, Bolekaja, Uber, Taxify, Gidicab, OCar, RideMe, plus including Kabukabu sef.

Even di orisirisi Okada dem wey dey now, follow for di Xmas clash “ ORide, Gokada, MaxOkada, etc etc.

Di ting be say, our branch executive no understand two matter wey dey inside dis Xmas clash.

Number one, dem no talk for di letter how we go take share di money wey go come from di gate fee.

Number two, dem come join we yellow taxi driver for di same group with danfo driver dem. Tori Olorun!

How dem go say make we, wey be old papa, enter field go begin kick ball with dose bobo (danfo driver dem) wey be say Igbo, Monkey tail, Alomo, Action bitters, Baby okwu, Agbeteshi, Sapele water and order orisirisi highness material dem na dia own?

Abi dem dey plan to finish us for dis odun? Dem no go succeed lai lai.

Jimoh, our branch chairman, don already take up di two matter, and I go tell una di outcome. Haba!

Make we jam again on Friday.

Tank you.

Tank you very much.

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

Guns boom, teargas rains as Wike, Bala Mohammed, Makinde, others battle for control of PDP National Secretariat

Guns boom, teargas rains as Wike, Bala Mohammed, Makinde, others battle for control of PDP National Secretariat

TD Africa takes centre stage at Schneider Electric Innovation Day Nigeria 2025, signs landmark MoU for AI-powered data centres

TD Africa takes centre stage at Schneider Electric Innovation Day Nigeria 2025, signs landmark MoU for AI-powered data centres

Full chat between Gen. Uba and rescuers before his capture and execution by ISWAP

Full chat between Gen. Uba and rescuers before his capture and execution by ISWAP

Canada warns against travel to Nigeria, 16 other African countries in latest security update

Canada warns against travel to Nigeria, 16 other African countries in latest security update

US Religious Freedom Coalition hails Trump for designating Nigeria a Country of Particular Concern, urges swift action

US Religious Freedom Coalition hails Trump for designating Nigeria a Country of Particular Concern, urges swift action

Outrage as Nigerian immigrant stabbed to death at home in South Africa

Outrage as Nigerian immigrant stabbed to death at home in South Africa

Tension in Enugu community as Gov Mbah's kinsmen protest military invasion

Tension in Enugu community as Gov Mbah's kinsmen protest military invasion

Kebbi Abduction: How my daughter escaped after bandits killed my husband — Vice Principal’s Wife

Kebbi Abduction: How my daughter escaped after bandits killed my husband — Vice Principal’s Wife

Genocide: U.S. lawmaker alleges Tinubu lying, protecting own interest

Genocide: U.S. lawmaker alleges Tinubu lying, protecting own interest

Anambra Assembly worker dies over inability to repay loan as workers begin indefinite strike

Anambra Assembly worker dies over inability to repay loan as workers begin indefinite strike

VDM, comedian Mr Jollof risk jail over in-flight fight

VDM, comedian Mr Jollof risk jail over in-flight fight

Strike: FG’s ‘No Work, No Pay’ threat will escalate looming crisis — SSANU president

Strike: FG’s ‘No Work, No Pay’ threat will escalate looming crisis — SSANU president

Nigerian doctor sent to prison in UK for $268,000 fraud

Nigerian doctor sent to prison in UK for $268,000 fraud

Tinubu has less than 600 days to be flushed out — PDP chieftain

Tinubu has less than 600 days to be flushed out — PDP chieftain

Key facts about proposed UK asylum system reforms

Key facts about proposed UK asylum system reforms

Northern Governors condemn abduction of schoolgirls in Kebbi

Northern Governors condemn abduction of schoolgirls in Kebbi

Mbah okays 2025 promotion exercise for Enugu civil servants

Mbah okays 2025 promotion exercise for Enugu civil servants

Military action key to ending banditry in Zamfara — Northern elders

Military action key to ending banditry in Zamfara — Northern elders

I am proud of Super Eagles, Osimhen declares

I am proud of Super Eagles, Osimhen declares

UK to tighten refugee status, expand forced family removals under new plans

UK to tighten refugee status, expand forced family removals under new plans

Tuesday, November 18, 2025 1:51 PM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025