Still on dat matter: If you Sowore me, I DSS you!

News Express |10th Dec 2019 | 1,987
Still on dat matter: If you Sowore me, I DSS you!

Man pikin don hear nwi. Since wen I talk am say make people helep me draft reply wey I go give Sikiratu for di Xmas Budget 2019 wey e submit to me, I no fit rest again. E come be like say di hole world wan draft di reply for me.

Last Friday, I manage publish some reply, but since den, di son of man no know peace again. Olorun Oba o!

Di people wey I no publish dia own letter talk say dem wan come do protest for our garage wey dey near Ikeja under bridge. See me, see wahala o! Se, na by force?

Me, I be taxi drive. If I begin siddon read and publish letter wey people write every day, which time I go take do my work with my guonguoro?

Se, I do mistake tell show una di Xmas Budget 2019 wey Sikiratu send to me? And sote I come beg una say make una helep me write di reply.

Okay, if na mistake, I dey sorry, I no go do so again. After all di matter na between me and my Siki Babe, noting concern una for inside. I even fit decide to double di budget for Sikiratu, e no concern una.

Yes nah. After all Sikiratu dey do am for me too. See like di order time wey I carry our Union Treasurer, Idowugo Madam Shine Buka wey Sikiratu dey work, we shack tire. Sikiratu wan take shackies finish me and Idowu.

My Siki Babe first use one, one bottle do welcome for us before im madam use jealousy send am go market and took over. And di order buka girl dem come use wayo send dia madam comot too, and took over. Se, una still remember dat tori?

And no be di first time Sikiratu don spend for my head be dat. Remember early dis year during election time wey Sikiratu say e wan become councilor for politricks? Na me e give di contract to use my guonguoro go round di hole Lagos and paste im poster. Una sabi how much e pay me for dat job?

So, if Sikiratu don do all dis better ting for me, why I go run jus becos e give me ordinary budget for keresimasi? Tell me why?

If no be amebo spirit dey worry una, why una go rush to write di reply wey I go give Sikiratu and even wan force me make I publish am for di hole world to see?

Di only ting be say, di budget big pass me small. Wia I go see 100k give Sikiratu to do Xmas? Tori Olorun!

E fit be true, as some of una talk, say na padded budget. But di ting wey I know be say, me and my Siki Babe go find way settle before Xmas.

And dose people wey dey plan to come carry placard for our garage jus becos I no publish una reply, I dey wait for una. E be like say una wan go smell rod dis Xmas becos, if you Sowore me, I go DSS you.Simple!

Protest ko, demo ni.

Make we jam again on Friday.

Tank you.

Tank you very much.

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

TD Africa takes centre stage at Schneider Electric Innovation Day Nigeria 2025, signs landmark MoU for AI-powered data centres

TD Africa takes centre stage at Schneider Electric Innovation Day Nigeria 2025, signs landmark MoU for AI-powered data centres

Full chat between Gen. Uba and rescuers before his capture and execution by ISWAP

Full chat between Gen. Uba and rescuers before his capture and execution by ISWAP

Canada warns against travel to Nigeria, 16 other African countries in latest security update

Canada warns against travel to Nigeria, 16 other African countries in latest security update

US Religious Freedom Coalition hails Trump for designating Nigeria a Country of Particular Concern, urges swift action

US Religious Freedom Coalition hails Trump for designating Nigeria a Country of Particular Concern, urges swift action

Outrage as Nigerian immigrant stabbed to death at home in South Africa

Outrage as Nigerian immigrant stabbed to death at home in South Africa

Tension in Enugu community as Gov Mbah's kinsmen protest military invasion

Tension in Enugu community as Gov Mbah's kinsmen protest military invasion

Kebbi Abduction: How my daughter escaped after bandits killed my husband — Vice Principal’s Wife

Kebbi Abduction: How my daughter escaped after bandits killed my husband — Vice Principal’s Wife

Genocide: U.S. lawmaker alleges Tinubu lying, protecting own interest

Genocide: U.S. lawmaker alleges Tinubu lying, protecting own interest

Anambra Assembly worker dies over inability to repay loan as workers begin indefinite strike

Anambra Assembly worker dies over inability to repay loan as workers begin indefinite strike

VDM, comedian Mr Jollof risk jail over in-flight fight

VDM, comedian Mr Jollof risk jail over in-flight fight

Strike: FG’s ‘No Work, No Pay’ threat will escalate looming crisis — SSANU president

Strike: FG’s ‘No Work, No Pay’ threat will escalate looming crisis — SSANU president

Nigerian doctor sent to prison in UK for $268,000 fraud

Nigerian doctor sent to prison in UK for $268,000 fraud

Tinubu has less than 600 days to be flushed out — PDP chieftain

Tinubu has less than 600 days to be flushed out — PDP chieftain

Key facts about proposed UK asylum system reforms

Key facts about proposed UK asylum system reforms

Northern Governors condemn abduction of schoolgirls in Kebbi

Northern Governors condemn abduction of schoolgirls in Kebbi

Mbah okays 2025 promotion exercise for Enugu civil servants

Mbah okays 2025 promotion exercise for Enugu civil servants

Military action key to ending banditry in Zamfara — Northern elders

Military action key to ending banditry in Zamfara — Northern elders

I am proud of Super Eagles, Osimhen declares

I am proud of Super Eagles, Osimhen declares

UK to tighten refugee status, expand forced family removals under new plans

UK to tighten refugee status, expand forced family removals under new plans

Kefas orders payment of outstanding pensions, gratuities in Taraba

Kefas orders payment of outstanding pensions, gratuities in Taraba

Tuesday, November 18, 2025 1:49 PM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025