Abeg, who helep me see my guonguoro key? (2)

News Express |25th Oct 2019 | 2,156
Abeg, who helep me see my guonguoro key? (2)

My chinko torch light phone ring tire, I no jus touch am. Touch ke.

Small time, my two woman pikin dem – Bisi and Funke – look demsef, dem no come fit hold dia laugh again.

I ask demwetin make dem laugh. Bisi say na Funke make am laugh, Funke say make I no mind Bisi, say na Bisi make am laugh.

I shout for dia head. I say if dem like make dem laugh from now till tomorrow, my own be say, anybody wey carry my guonguoro key make e bring am out kia kia before I close and open my eye.

Na dat time my wife Bose tell me say, if I like make I close my eye, na im be say I go close am till thy kingdom come.

Bose tell Bisi and Funke say as di rain don stop, make dem prepare go market go buy wetin e go take cookefo riroandeja tutuwey dem go useamalajob for dis cold weda.

I come talk am for my mind say, so dis woman and im pikin dem wan cook fresh fish vegetable soup with amala take enjoy as rain jus fall finish? Tori Olorun!

As Bisi and Funke comot go market wey dey for dat ourAbule Egba junction, Bose ask me weda I never still see my guonguoro key.I tell am say no. Na im Bose enter bedroom.

Small time Bose say, “Baba Bisi, come see your key here o!”

Quick, quick, I rush enter room. Bose jam door di bedroom door ppuuoorrhh, and lock am.

Bose jump enter for bed as God take create am. E come tell me say dat blanket wey I wan carry go cover anoder person for outside, im sef need am for dis cold weather. E say after all, na im be di origin owner of di blanket, any order person na counterfeit.

So, Bose and dis pikin dem been hear everyting wey me and Sikiratu talk for phone dat time? So, na Bose, my wife, plot all dis coup for me make I no comot for house today? Olorun Oba o!

Na dat day I sabi say, if woman plot coup for you like dis, dia own coup dey pass Dimka own. I swear!

Well sha, I put my chinko phone for silence make dat yeye buka girl no disturb me again. I jump inside bed and perform my duty till our pikin dem come back from market.

Later, na so di hole family come enjoy fresh fishefosoupand hotamala. Na after dat Bose bring out di key, smile and hand over to me. And me sef smile, collect di key. Everybody for house come laugh.

But me, I no fit go any wia again for di day. After all, dat ting wey I dey find go for Sokoto, e dey for my shokoto trouser.

Make we jam again on Tuesday.

Tank you.

Tank you very much.

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

JUST IN: Security operatives provide heavy cover as Wike's men take over PDP National Secretariat

JUST IN: Security operatives provide heavy cover as Wike's men take over PDP National Secretariat

Images show hostel where Kebbi schoolgirls were abducted

Images show hostel where Kebbi schoolgirls were abducted

Akin Osuntokun: Nigerians ‘romanticising rogue behaviour’ as Military violates constitution

Akin Osuntokun: Nigerians ‘romanticising rogue behaviour’ as Military violates constitution

Tinapa handover by AMCON Marks ‘Rebirth’ of Cross River’s economy, says Governor Otu

Tinapa handover by AMCON Marks ‘Rebirth’ of Cross River’s economy, says Governor Otu

Tinubu: Public perception of Judiciary not favourable, Judges must shun corruption

Tinubu: Public perception of Judiciary not favourable, Judges must shun corruption

Lagos N200bn bond oversubscribed by 55% at N310bn

Lagos N200bn bond oversubscribed by 55% at N310bn

Tension as factions battle for PDP secretariat

Tension as factions battle for PDP secretariat

FG receives Benin bronzes repatriated from US

FG receives Benin bronzes repatriated from US

People will answer for financial recklessness in museum Project — Edo Commissioner

People will answer for financial recklessness in museum Project — Edo Commissioner

PDP Govs Responsible For Crisis In Party — Anyanwu

PDP Govs Responsible For Crisis In Party — Anyanwu

Dangote clarifies drop in petrol pump price

Dangote clarifies drop in petrol pump price

Egypt FA confirm talks for EARLY Mohamed Salah release for AFCON

Egypt FA confirm talks for EARLY Mohamed Salah release for AFCON

NMDPRA: We will not allow cartels take over downstream petroleum sector

NMDPRA: We will not allow cartels take over downstream petroleum sector

Ex-Harvard president Larry Summers steps back from public role after Epstein email release

Ex-Harvard president Larry Summers steps back from public role after Epstein email release

Switzerland joins Italy, France, Austria, Germany, Netherlands, Hungary and more as Canada faces tough new travel requirements for European trips in 2026: New updates you need to know

Switzerland joins Italy, France, Austria, Germany, Netherlands, Hungary and more as Canada faces tough new travel requirements for European trips in 2026: New updates you need to know

BREAKING: Heavy security presence as PDP factions hold parallel meetings in Abuja

BREAKING: Heavy security presence as PDP factions hold parallel meetings in Abuja

The top 10 most peaceful countries in Africa 2025

The top 10 most peaceful countries in Africa 2025

Ondo Refinery, FTZ Project Take Shape with Formalized JV Platform

Ondo Refinery, FTZ Project Take Shape with Formalized JV Platform

Serial intruder who accosted Ariana Grande at Wicked premiere in Singapore sentenced to 9 days in prison

Serial intruder who accosted Ariana Grande at Wicked premiere in Singapore sentenced to 9 days in prison

International soccer’s 148th-best team is pulling crowds of nearly 50,000 people

International soccer’s 148th-best team is pulling crowds of nearly 50,000 people

Tuesday, November 18, 2025 10:34 AM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025