Abeg who helep me see my guonguoro key?

News Express |22nd Oct 2019 | 2,249
Abeg who helep me see my guonguoro key?

To do taxi driver work for Lagos no easy rarara. I swear! If na lie I talk, make I tanda naked baf for bafroom.

E get day wey man go siddon for garage from morning till night, no passenger go jus show face. And e get di day wey be say you go work from morning till morning, you no go even get chance chop.

And dis rain wey come dey fall everyday so, come dey cause anoder wahala for road. Any day rain jus drop small like dis, na so all di road for Lagos go turn to River Jordan.

Wen e dey like dat, man pikin go jus find one place park till di rain stop. If you say make you do shakara put your motor for road wen rain dey fall, hmn, na so water go jus carry you, your passenger and your motor go trowey for Lagos lagoon. Olorun maje!

Na im make as heavy rain fall yesterday morning, I say make I siddon for house small. All of us complete for house - me, my wife Bose, my first woman pikin Bisi and im sister Funke.

Small time, na im my chinko torch light phone begin ring. Wen I see di name of di person wey dey call, I no gree pick di call. Dat my busybody pikin, Funke come tell me say daddy pick your call nah. I ask am wetin concern am.

Di phone ring again, I no pick. E ring di third time, na im I cut am piiaam.

If you see di kind eye wey Bose take look me wen I cut di call, if small pikin see di eye, e must to get convulsion.

Na so di phone come ring again. Torin Olorun! Abi dis buka girl wan cause wahala for my family?

Icarry di phone rush go for backyard. I pick di call, na im Sikiratu begin hala me why I no wan pick im call.

I tell Sikiratu say weda e no know say I dey for house. E say how e go take know, weda e be wintch to sabi say by 10 o’clock am in di morning I still dey for house.

I ask am weda e no see dis kind rain wey dey fall. Sikiratu tell me say na even becos of di rain e call me. E say e wan ask me weda I no go come dia buka (Madam Shine Buka) , say cold too much, make I come cover am small.

Sikiratu say di rain don dey come down, make I begin dey come, say e dey wait for me. E say if I no come now, now, now, make I no talk to am again lai lai.

See as dis buka girl hold me for work o! Well, I like my Siki Babe. I tell am say “Your wish is my commander.”

I rush enter parlour again. I tell Bose and my two woman pikin dem say, as rain don dey stop small small, I wan begin go our garage wey dey near Ikeja under bridge.

Na Funke first tell me bye bye. Bisi do like say e too busy with di book wey e dey read. Dia mama do like say e no hear wetin I talk. Me I no mind dem, I must to go wia I wan go.

I rush go on top of cupboard wey I dey keep my guonguoro key, I no see am. I use hand search everywia, I no see am. I look inside di cupboard, I look under, I no still see di key.

Na im I ask who see my guonguoro key for here. Nobody answer me. I look Bose, Bose come ask me why I dey look am like dat. I ask am weda e see my key. My wife ask me wetin concern am concern my key.

E come tell me say make I find di key well well come begin dey go, sebi I don turn to blanket wey dey cover cold.

I come talk am for my mind say, abi dis people been come take style listen wen I dey talk for phone with Sikiratu for backyard? Se dem don hide my guonguoro key make I no comot?

Small time, na im my phone come dey ring again ti-ti-ti, non stop. And na Sikiratu. Olorun Oba o!

(To be continued)

Make we jam again on Friday.

Tank you.

Tank you very much.

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

JUST IN: Security operatives provide heavy cover as Wike's men take over PDP National Secretariat

JUST IN: Security operatives provide heavy cover as Wike's men take over PDP National Secretariat

Images show hostel where Kebbi schoolgirls were abducted

Images show hostel where Kebbi schoolgirls were abducted

Akin Osuntokun: Nigerians ‘romanticising rogue behaviour’ as Military violates constitution

Akin Osuntokun: Nigerians ‘romanticising rogue behaviour’ as Military violates constitution

Tinapa handover by AMCON Marks ‘Rebirth’ of Cross River’s economy, says Governor Otu

Tinapa handover by AMCON Marks ‘Rebirth’ of Cross River’s economy, says Governor Otu

Tinubu: Public perception of Judiciary not favourable, Judges must shun corruption

Tinubu: Public perception of Judiciary not favourable, Judges must shun corruption

Lagos N200bn bond oversubscribed by 55% at N310bn

Lagos N200bn bond oversubscribed by 55% at N310bn

Tension as factions battle for PDP secretariat

Tension as factions battle for PDP secretariat

FG receives Benin bronzes repatriated from US

FG receives Benin bronzes repatriated from US

People will answer for financial recklessness in museum Project — Edo Commissioner

People will answer for financial recklessness in museum Project — Edo Commissioner

PDP Govs Responsible For Crisis In Party — Anyanwu

PDP Govs Responsible For Crisis In Party — Anyanwu

Dangote clarifies drop in petrol pump price

Dangote clarifies drop in petrol pump price

Egypt FA confirm talks for EARLY Mohamed Salah release for AFCON

Egypt FA confirm talks for EARLY Mohamed Salah release for AFCON

NMDPRA: We will not allow cartels take over downstream petroleum sector

NMDPRA: We will not allow cartels take over downstream petroleum sector

Ex-Harvard president Larry Summers steps back from public role after Epstein email release

Ex-Harvard president Larry Summers steps back from public role after Epstein email release

Switzerland joins Italy, France, Austria, Germany, Netherlands, Hungary and more as Canada faces tough new travel requirements for European trips in 2026: New updates you need to know

Switzerland joins Italy, France, Austria, Germany, Netherlands, Hungary and more as Canada faces tough new travel requirements for European trips in 2026: New updates you need to know

BREAKING: Heavy security presence as PDP factions hold parallel meetings in Abuja

BREAKING: Heavy security presence as PDP factions hold parallel meetings in Abuja

The top 10 most peaceful countries in Africa 2025

The top 10 most peaceful countries in Africa 2025

Ondo Refinery, FTZ Project Take Shape with Formalized JV Platform

Ondo Refinery, FTZ Project Take Shape with Formalized JV Platform

Serial intruder who accosted Ariana Grande at Wicked premiere in Singapore sentenced to 9 days in prison

Serial intruder who accosted Ariana Grande at Wicked premiere in Singapore sentenced to 9 days in prison

International soccer’s 148th-best team is pulling crowds of nearly 50,000 people

International soccer’s 148th-best team is pulling crowds of nearly 50,000 people

Tuesday, November 18, 2025 10:34 AM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025