ADVERTISEMENT
ADVERTISEMENT

My new dross dey shack me

News Express |13th Nov 2018 | 4,249
My new dross dey shack me

Di kind speed wey people dey take multiply for dis our obodo Naija surprise me, no be small

I sure say if gofment say made dem count our contry people again, you go shock say we don dey near one billion. Weda or wedan't you believe am, na you sabi. Lagos only go don dey near China people for number, dat is if we never overtake dem be dat o.

If you reach Idumota or Oshodi, you go tink say di hole world don run come for Lagos. And take style reach Mile 2, Yaba, Oyingbo, Iyana Ipaja, Agege, Egbeda, Ikotun Egbe, Ikeja, Ajah, Obalende, Okokomaiko etc, etc, na dat time you go see people like sand sand for road. If you trowey pin for up, di pin no go reach ground lai lai. I dey always wonder how food dey take reach all dis people wey dey for Lagos. And new people still dey land for Lagos every day o!

If you drive for your motor, na wahala. Na so you go siddon for motor for inside go-slow so-te your nyansh go nearly peel. If you say make you park your motor and join BRT, you go wait till thy-kingdom-come becos of people wey don line up dey wait like from Benin City to Okada Town. (Dat BRT dey spoil our business sef). And if you say make you take leg waka go your way, dat one sef na helele.

Like di order dey wey I drop one passenger like dat for Marina, as I wan go back to our garage for near Ikeja under bridge, I come remember say my dross don dabaru finish because of over use.

Every day, na so I go wear one dross for under shokoto, dey drive my guonguoro go every wia for Lagos. How di ting no go dabaru? Dat na dross abuse nah.

Na im I chuk head put for Marina Car Park, den take leg waka enter Balogun Market to go find anoda dross buy. My broda, come see as people just full everywia. JJC for Lagos fit begin fear say weda war wan start. Everybody just dey for hurry, you go dey wonder wia dem dey hurry go. Okada and im senior broda Keke Marwa wey dem talk say dem don ban since, no go even allow person see road waka well. Tori Olorun!

People wey dey waka sef, na so dem go take hand and body dey jam one anoda. But dat one no pain me becos plenty of di people wey take dia body jam me na sisi dem. One of dem like dat take im full head lamp nack me for back. Wen I turn back, di sisi say “Am sorry.” E tink say I don vex, e no know say di ting sweet me no be small. I just look am, den come smile small.

Everywia just jam pack. Una kukuma sabi say Christmas don dey reach, so everybody dey go buy market for Isale Eko. Na so anoda sisi take hand sef brush my kini. Na dat one nearly spark me for head. Instead make di sisi say “Am sorry” like di first sisi, e just look me anya anya, den come smile one kind wicked smile like dat. I fit swear say di ting also spark am for head. But me I no dey take dat kind ting play at all, at all. Imagine, if two people head and body come spark for main road, who go pour who water? And if my wife, Bose hear say anoda woman touch im kini, my own don finish be dat nah.

But sha, I manage buy di ting wey I wan buy for Balogun market, den go carry my guonguoro for Marina car park, begin dey go our garage for Ikeja.

My troublem now be say, since dat day, e just dey do me like say make I no wear clothe for body so dat people go dey see my new dross. And na Jumper and Shokoto I dey wear so I no fit begin sag like all dis Yahoo Boys dem. Se no be craze be dat?

Make we jam again dis Friday.

Tank you.

Tank you very much.

And tank you very very much indeed.

Comments

Post Comment

Sunday, June 1, 2025 2:21 AM
ADVERTISEMENT
Over 70 years Shell banner
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025