NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.
Na now I sabi say Eledumare na B-a-b-a! But di ting wey dey wonder me na how dis Eledumare dey take do im own ting.
Aldough, di last time I follow my wife Bose go Crossover night for dia church wey dey for Pen Cinema, dia pastor talk am say man no fit understand God way lai lai. Na now I come see di sense for wetin dat pastor talk.
If no be so, wetin go make Eledumare continue to give person di ting wey e no pray for, but di people wey wan dat same ting gan, dem dey sweat before dem get am, and some no dey even see am rarara.
My broda, na so we siddon for garage di order day wey rain dey fall like say di world wan dabaru. If rain fall like dat, I no dey enter road lai lai. For dis flood time? Any place wey di heavy rain meet me, na for dia I go find one corner park my guonguoro till di rain fall finish.
Na so me and my union member dem dey do anytime rain fall like dat. Person wey dey for road wen heavy rain dey fall na im sabi, especially for dis our Lagos road dem, anyting fit happen.
So dat day, di rain start like 7 o’clock am in di morning wen all of us don reach our garage wey dey near Ikeja under bridge. All of our union member dem kukuma siddon for garage, dey talk, dey play, some dey shack, some dey smoke.
As di rain jus reduce small, one okada man like dat show face for garage. Di bobo dey in a hurry no be small. As e dey rush, to say e get white body, I for tink weda e come from Russia.
Di okada man ask who be Idowu for here. I say take am easy, na wetin happen. E say weda na me be Idowu, I say no be me. All dis time Idowu, our union treasurer, jus dey bone make di guy no suspect am.
Di okada man come talk say anywia sha, dem give am dis address for one hospital like dat wey dey for Dopemu make e come tell Idowu say im wife don born twins since day before yesterday. But di hospital no gree discharge am since e no drop any money before e born.
I tell di okada man say I deliver im message to Idowu wen e come back. Na im di okada man go. I jus hear Idowu draw one kind heavy breath like dat. Na dat time Idowu come nack me di tori:
Di small sisi wey dey always come sell Pure Water for our garage na im Idowu give belle. Idowu na di small sisi real customer. Wen di sisi no dey come like before, we ask Idowu wetin happen, e say make we no mind di yeye girl, say e be like say im Papa don send am go marry husband for dia village.
We no know say Idowu don give di small sisi belle, so-te, e go rent house for am for Dopemu. And since den, Idowu no gree go see am till e born so.
And di ting be say, two of Idowu wife dem don born twins for am tele-tele. Now di four both of dem na woman pikin dem! Dis one again na twins and na two woman pikin too. Plus including order woman pikin dem wey order women born for am o. Tori Olorun!
Na im I come dey wonder which kind manure dey for Idowu kini. And if you see am, na real lepa shandy Idowu be. E jus long trowey, no fat for body.
May una fear any man with small yansh o. Idowu na one of dem.
Make we jam again next week Tuesday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very very much indeed.
•Credit: Matilda’s Blog.