ADVERTISEMENT
ADVERTISEMENT

Me, I no be Agbado taxi driver ra-ra-ra!

News Express |25th Oct 2022 | 336
Me, I no be Agbado taxi driver ra-ra-ra!

One ting wey dey pain me well well for dis our union member dem be say, dem too get long troat. Anyting wey dem see, if dem no chop am sote dem nearly quench, dem no go comot eye.

Some of dem be say, na monkey tail be dia chewing stick for morning. Make I tell una, monkey tail na ogogoro plus igbo togeder.

Di woss of dem na all dis danfo driver dem. How man pikin go dey take monkey tail wash im mouth before e enter steering to drive in di morning? Na im make dem dey fall inside Lagos lagoon every day.

Now na Agbado (corn) dey reign. You go see some driver dem go take one hand hold steering, take di order hand hold Agbado. Dem no go remember say na people dem dey carry. If anyting happen, tell me, how dem go do am, wen e be say all dia mind dey inside di Agbado?

No be only driver dem. Any wia you go now, na so so Agbado you go dey see for everybody mouth – for market o, road o, school o, office o, everywia! Tori Olorun!

Shey Agbado dey bele full person?

Since wen Baba Emilokan talk say make Naija people dey chop Agbado, Ewa and Garri, say dem good for body, na so everybody don chuk head put for dose food, especially Agbado.

For our garage wey dey near Ikeja under bridge, I don warn my union member dem tire. I dey always tell dem for our meeting say, no be becos man dey do taxi driver work, na im be say all of us don become agbero. After all, I hear say for oyibo land, even people wey don read plenty book dey do taxi driver work. Haba! Shey Agbado na food?

I jus dey pray say dis ting wey happen to Sule last week go take style teach all our union member dem lesson about dis Agbado wahala.

(To be continued)

Make we jam again on next week Tuesday.

Tank you.

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

•Credit: Matilda’s Blog.

Comments

Post Comment

Friday, June 20, 2025 4:29 AM
ADVERTISEMENT
Over 70 years Shell banner
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025