NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.
I tank Eledumare say rain don dey go small, small.
Since when rain start dis year, to see passenger carry na troublem. Na so man pikin go siddon for our garage wey dey near Ikeja under bridge, dey look road ti-ti-ti-ti, weda passenger go show face as rain dey fall. For wia!
Even wen you manage see one passenger, wen you drive enter for road, if water no swallow your taxi, your taxi go swallow water. But there must be a swallow. Una kukuma know di orisirisi river dem wey dey full for Lagos road wen rain jus shower small.
Na because passenger no dey for rain, dat’s why our union member dem dey gree for anybody wey make mistake come, even with chechere money.
And now, time for politriks come join.
All dis politriksian dem, dia mouth too sweet. I swear!
Since wen dem start dis dia 5 million man march, na my guonguoro dem dey use pass. And na so dem go carry one kind chechere money give me. Dem go tell me say make I jus hold dat one, say di real campaign never start. Dem go tell me say, wen campaign start, na dat time I go enjoy, say now I be one of dem.
Our union oga patapata for Oshodi come carry me di order day. Dem nack poster full all di body of my guonguoro. Na so I drive follow dem everywia for Lagos. If I tell you how much e pay me after di hole waka, you no go believe. Di only ting e tell me be say, as I dey work with dem wey be Emilokan, my own go better wen di real campaign start. I say okay o.
Before dat one sef, na so di order people been come carry me and my guonguoro di same way. I drive follow dem everywia for Lagos – from stadium wey dey for Surulere, pass Ojuelegba, enter Ikorodu Road. We pass Fadeyi, Onipanu, Palmgrove, Obanikoro, Anthony, Idi-Iroko, den go turn for Maryland.
As we finish dat day, dia oga pay me small money like dat. E say make I jus manage am for my fuel, say as I don join dem wey be OBIdient, dem go dey use me everyday and I go enjoy well well. I say okay.
(To be continued)
Make we jam again next week Tuesday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.
•Credit: Matilda’s Blog.