NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.
Abeg, who know wia all dis ASUU people dey live, helep me go tell dem say dem don cause wahala for my family.
See my two woman pikin dem – Bisi and Funke – wey JAMB don jam dem for four years. Dem siddon for house since dat time, sote all our nebour for Abule Egba dey do amebo say my pikin dem resemble me for olodo. Dem dey talk am for back say shebi dia papa na taxi driver, wetin go make im pikin dem sabi book?
I jus dey do like say I no hear becos dem no talk am for my face. If no be so, I for tell dem say na condition make me come do taxi driver work for Lagos.
I for tell dem say make dem go my village for Ogbomoso, go ask weda anybody for my class don pass me before for exam up till Standard 5 wey I run come Lagos becos of Arike papa wey wan use African Insurance finish me say na me give im pikin belle.
My pikin dem sabi book like me, only be say JAMB no get respect for anybody.
Eledumare come make am say, dis year, Bisi and Funke come jam JAMB. Na so we begin happy, begin dey prepare make dem enter uniservity. Na dat time ASUU come start strike. Tori Olorun!
My pikin dem don siddon for house sote dem don tire.
Di ting wey make me dey fear now be say, I no come understand my pikin dem again.
Na early morning I dey put for guonguoro for road everyday. Any day I say make I jus reach house small before I go back to our garage wey dey near Ikeja under bridge, I no go see my pikin dem for house.
One day like dat, I dey for room hear wen Funke, my second woman pikin, tell im senior sister Bisi say, as ASUU no wan make dem go school again, weda make im kukuma get belle and born pikin. Olorun Oba o!
Bisi talk say, im own, e wan go learn tailor work, say to siddon for house don tire am.
Wen I tell dia mama, my wife Bose, wetin I hear our two woman pikin dem dey talk for parlour, Bose say im sef don tire. E say Bisi and Funke no dey siddon for house again. Every day, na so dem go comot for house. Dis one go say e dey go buy someting for Oshodi, di order one go say e dey go see im friend for Dopemu.
E get some day wey I go reach house around 9 o’clock pm in di night, I no go meet one of dem or di two both of dem, as di case may be. Wen dem come back and you ask dem wia dem go, dem go ask me wetin I wan make dem siddon dey do for house every day.
Shey una see as dis ASUU people don scatter my family? If dem don tire to do dia work, why dem no go sell for market?
If by Monday ASUU no go back to dia work, I know wetin I go do dem. I no fit siddon look dem dey spoil my own rararara. Instead, na dia own go spoil.
If I lai, make I baf naked for bafroom.
Make we jam again next Tuesday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.
•Credit: Matilda's Blog.