Oga di owner don catch thief

News Express |2nd Aug 2022 | 483
Oga di owner don catch thief



Na now I believe all di ting wey our papa dem talk tele tele before dem peme.

I remember dat time wen we small for our village for Ogbomoso. Wen anybody hide do bad ting, my papa go say make dem no worry, say one day go be one day wey monkey go go market e no go come back.

And now, na so my wife Bose dey do anytime e suspect me with all dis Lagos sisi dem.

If I come back late, noting wey I go tell my wife make e believe. Weda I do overtime o, or I get flat tyre o, or my guonguoro engine knock o, or na Go-slow catch me for road-o, all dat one no concern Bose. Wen e don talk bla, bla, bla finish, di ting wey e go take end am be say “everyday na for thief and one day for di owner”. Na only Bose know who be thief and who be owner, and im ting wey dem dey thief every time.

Na so I come back di order day, Bose begin hala sote our nebor dem come out.

I take style go inside bedroom. Bose come hold me for my shokoto trouser. E say I must tell am wetin I do for outside wey make me come house by 12 O’clock am in di midnight.

E say wen I don go do ishekushe finish with all dose Lagos ashi dem, I go carry my useless body come meet am for house. E say weda I wan take COVID-19 finish am? Like say Covid and AIDS na di same mama born dem.

Bose no let me talk. Our two woman pikin dem – Bisi and Funke – beg dia mama tire make e lef my shokoto trouser, na lie.

Afraid come catch me sef weda dis Ondo woman don run mental. You no go believe say na so Bose hold me for my shokoto trouser dey talk till 2 O’clock a.m. in di morning wen sleep catch am.

Before den, Bisi and Funke don tire to beg dia mama. Na as dem hold dia mama dey beg am, na im sleep jus carry di two both of dem. Me sef wey don tire, as Bose sleep, na im I close my eye, begin sleep but my wife hand still dey for my shokoto trouser and na so Bisi and Funke hand still dey hold dia mama for wrapper.

(To be continued)

Make we jam again on Wednesday.

Tank you.

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

•Credit: Matilda’s Blog.

Comments

Post Comment

Wednesday, September 24, 2025 12:35 AM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025