My pikin no go marry old cargo lai lai (2)

News Express |26th Jul 2022 | 718
My pikin no go marry old cargo lai lai (2)



I come tell Mutiu say, “My second woman pikin name na Funke. So wetin come happen?”

Mutiu say na my pikin e wan marry wey go take care of am for Lagos incase na true say Coro don come back.

Mutiu, marry my pikin? Olorun maje!

See Mutiu wey be say any inter-state drop wey e carry passenger go, e must to marry wife for dia.

Im wife number one with 5 pikin dey for im village for Kwara. Wife number two dey Minna with 2 pikin. Wife number three dey Ibadan with 4 pikin. Na wife number four dey Kogi wey show am pepper dat Coro time.

Now Mutiu wan marry my pikin and keep for Lagos as wife number five. My pikin wey Mutiu see wen I born am o. My pikin wey dey wait make e enter uniservity with im senior sister Bisi wen dem open school after dis ASUU wahala o.

I tell Mutiu say, make e no worry, say I go give am reply tomorrow. Oloribruku!

I come talk am for my mind say, even if my pikin wan marry now, how e go lef tear rubber chassis, come marry second hand cargo like Mutiu?

I dey wait for am make e come ask me again. Mtcheewwww!

Make we jam again on Saturday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

•Credit: Matilda’s Blog.

Comments

Post Comment

Wednesday, September 24, 2025 2:31 AM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025