ADVERTISEMENT
ADVERTISEMENT

Sikiratu junior broda hear nwi for Agege (2)

News Express |8th Jul 2022 | 429
Sikiratu junior broda hear nwi for Agege (2)



I come take head do arithmetic. I come remember di contribution wey we start April for our garage. Na six of us for our union gree to dey put down N5, 000 every week. And di money dey for our union treasurer, Idowu hand.

Which kind contribution I dey do wen I get emergency for hand? And na my name dey last for di list. Dat mean say I go wait till September before e reach my turn. Olorun Oba o!

Idowu don close for di day. I come decide for my mind to go meet am for house and tell am say our union chairman Jimoh wey suppose to take di contribution dis week no dey town, make I take im turn, take settle emergency troublem. But if I tell Idowu and e wan begin do gragra, I go tell am say I no do di contribution again. Say I don step aside make e return my money.

Na im I tell Femi, Sikiratu junior broda, make e enter my guonguoro make we go Ogba. Na Ogba Idowu dey live. But I no tell Femi wetin I dey go do for dia.

Wen we reach Ogba, na only Idowu wife wey jus born anoda twins (2 woman pikin, trust Idowu) we see for house. E say im husband carry one passenger like dat for charter go Sango Otta.

We reach Idowu house by 12 o’clock pm in di afternoon. Na so we begin wait for am tititi. 1, 2, 3, 4 o’clock pm in di evening, Idowu no show sign to come back. Na so we take style wait for am till 8 come nack.

But I come remember Fatima wey Idowu give belle. Fatima dey sell cold pure water tutu re for Idumota.

I remember say Fatima also born twin, 2 woman pikin too, last Friday for Idowu. Na dat time I know say Idowu don play im wife boju boju. No be any passenger e carry for charter go Sango Otta. Na naming ceremony e go do for di twins wey Fatima born for am last week Friday.

I tell im wife say we wan begin go. Say I go see Idowu tomorrow for garage.

I never see di kind Go slow wey dey for road like dat yesterday night own. As we manage reach Emmanuel bus stop for Agege, one car wey dey for my front jus stop for middle of di road. I wan yab di driver but I say make I overtake am first. As I pass dem small, na im I see 10 olopa dem for our front with gun. Dem begin open fire. Tear gas come scater everywia. I no know say di four bobo wey dey inside di car na amu robber dem. Dem begin open fire for olopa also. Na so me and Femi see oursef for di centre of di battle.

Bullet jus dey fly left, right and centre. Before I open door sef, Femi don jump inside di small bush wey all dose agbero for dat bus stop dey go shit. I jump follow Femi like blind person, I no even off my guonguoro engine. Tear gas wan commot my eye trowey for ground.

As Femi wan move body for inside di small bush, e jus put leg for one babanla shit like dat. Di ting draw pass okro soup. Na so e trowey Femi for up, turn am for air 7 time, den land am for ground ppoossaah! Femi mouth jus bury patapata for inside Agege agbero shit. Na for dia we take cover. Femi wan open mouth tell me someting, e no fit. I take hand give am sign say make e no talk.

Wen olopa don capture all di 4 amu robber, na dat time we carry hand up like rebel soldier wey surrender, begin dey come out. Come see shit jus plaster all our body like concrete. I tell Femi make e find im way, say I go call Sikiratu later dat night.

Wen I reach house, na for outside I begin comot clothe. I use like 5 bucket of water, plus sand, soap, Izal and sponge take baf dat night.

Up till dis time wey I dey nack una dis tori so, I never tell anybody for my house wetin I see for night.

Make we jam again on Tuesday.

Tank you.

Tank you very much.

And tank you very, very much indeed.

•Credit: Matilda’s Blog.

Comments

Post Comment

Friday, June 20, 2025 8:22 AM
ADVERTISEMENT
Over 70 years Shell banner
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025