Eledumare no go make us see wetin pass us o. Say Amin!
Na so I siddon jeje yesterday for our garage wey dey near Ikeja under bridge, dey tink. Shishi no dey my pocket and e come be say na weekend we wan enter so. I comot for house dat morning very early, I tink say as e be Friday, I go quick see passenger wey go take me for charter, or even drop sef, go Isale Eko. For wia!
Even fly sef no come. And na so hungry come dey nack me for belle kom kom kom. Common twenty naira sef to take buy pure water take cool my belle no dey my pocket.
Di next ting be say, my torchlight chinko phone begin ring. I look, I see say na Sikiratu dey call.
I pick di call. Sikiratu ask me weda im junior broda don reach our garage. I tell am say I no see anybody like dat. E say e give am my name and address of our garage. Say e give am letter to give me. I say okay, I still dey garage.
Sikiratu no even drop phone wen I see one bobo enter. E ask me weda Oga MAT dey. Me sef use question to answer im question, as correct Naija man.
I ask am why e dey find Oga MAT. Di bobo tell me say e get letter for Oga MAT. I ask am weda e be Sikiratu junior broda. E say yes. I say na me be Oga MAT. Di bobo give me di letter.
Wen I read di letter finish, I begin sweat.
Sikiratu say next week na Sallah but I come dey do like say I no know. E say e wan buy ram and drink, plus including orisirisi tings wey e go take cook Sallah food. E say, e for tell me make I buy Sallah clothe for am, but e know say money no dey for Naija. E come talk say di money for di Sallah ram, drink and food go be like 100k. But e get half, make I jus helep am with half wey be 50k. Tori Olorun!
I come remember say, last Keresimasi, di kind tings wey Sikiratu do for me, mouth no fit talk am. E buy me new shokoto trouser, e buy me shoe plus including goldwatch. E no finish dia, e still give me 35k join am make I take do Keresimasi for my family. I no suppose to even wait make Sikiratu ask me before I do someting for am for dis Sallah wey dey come so.
(To be continued)
Make we jam again on Friday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.
•Credit: Matilda’s Blog.
NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.