ADVERTISEMENT
ADVERTISEMENT

Sikiratu sef wan be President (2)

News Express |27th May 2022 | 413
Sikiratu sef wan be President (2)



Na so me and Sikiratu comeembreastwell well. We hold oursef for like 5 minute sote my leg come begin shake for ground. Di girl wan take im Vitafoam wound me for chest. But na sweet wound sha.

I come ask Sikiratu wetin be im secret for dis kind fine wey e fine so. E tell me say e dey work now for one oil company, na im make I know see am since.

I ask am which work e dey do for di oil company. E say e be PA to oga patapata of di company. I no know wen I shout, PA?

Everybody for garage come dey wonder wetin make me shout like dat.

Imagine, Sikiratu, P.A? Which day dis buka girl go school? Me wey even stop for Standard 5 sef for my village night school, I better pass am.

E come be like say Sikiratu sabi wetin dey for mind. E bring out im CV wey e take get di oil company work.

See di orisirisi certificate wey dis buka girl claim say e get. Im WAEC all na A1. E even get diploma sef. Tori Olorun!

I look Sikiratu from head to toe. Afraid come catch me for am. So dis buka girl don follow do Oluwole?

I tell am say sebi e know say I sabi am well well, if dem catch am nko? Sikiratu come laugh. E say make I siddon dia, na so train go lef me for station.

Sikiratu say small time e go even lef di oil company work, enter politricks wey e go take become senator and after dat e go be governor, and from dia e go buy form wey e go take be president. Olorun Oba o!

I jus dey look as Sikiratu mouth dey do tatatata like typewriter. I come talk am for my mind say, so now na everybody wan be Naija president?

Sikiratu say make I enter my guonguoro make di two both of us go shack for Madam Shine buka, im former work place.

Everybody for buka shock to see new improve Sikiratu.

Dat night, na small remain make I park my guonguoro for road, begin crawl dey go our house wey dey for Abule Egba.

In short, Sikiratu finish me with shack and point-and-kill pepper soup dat day. Sikiratu don turn me to party delegate as e wan be president.

Make we jam again on Tuesday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

•Credit: Matilda’s Blog.

Comments

Post Comment

Friday, June 20, 2025 2:46 PM
ADVERTISEMENT
Over 70 years Shell banner
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025