Sikiratu sef wan be Presido

News Express |24th May 2022 | 447
Sikiratu sef wan be Presido



Dis my Siki Babe sef! I no know who go finish who for dis world, weda na me go finish am or na im go finish me.

Di ting wey I never still sabi be say, upon all di orisirisi tings wey Sikiratu don do me for dis Lagos since wen I sabi am, anytime my eye jam am like dis, my heart go jus dey do jigi jigi like railway.

Na only Eledumare know weda dat buka girl no dey use African Insurance for me.

Since dis month show face, me and Sikiratu no see. E no call me, and me sef no call am.

Last Thursday one sisi like dat come our garage wey dey near Ikeja under bridge. Wen I first see di sisi, I tink say na one Americana babe wey jus land for Naija.

Di glass wey e use cover im two eye na who send you come. Come see di tight jeans wey e wear, my broder, if you see am you must to swallow saliva becos di ting make im boysquarter shoot out pim.

And di sisi come top am with one kind wicked body hug T-shirt wey make di two paw paw for im chest shoot out like say e wan chuk person eye.

I come talk am for my mind say e go be packaging science dis sisi been read for school. Di sisi sabi pack everyting for im body no be small, front and back.

And e come be say na me di sisi find come for garage. I say na wa o.

Wen di sisi waka come near me, na im e call me Oga MAT! Shioo! Na dat time I sabi im voice. Na Sikiratu!

(To be continued)

Make we jam again on Friday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

•Credit: Matilda’s Blog.

Comments

Post Comment

Wednesday, September 24, 2025 6:41 AM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025